Victor Ejuvwevwo Arikoro

From Wikipedia
Victor Ejuvwevwo Arikoro


Victor Ejuvwevwo Arikoro (dem bon am for Januari 13, 1942),[1] wey dem also sabi as V. E. Arikoro, na di Naija akbishop, author, spiritual lida, fonda an oga kpatakpata of di Pentikostal Afrikan Chorch.[2] Afta e don komot from di Afrikan Chorch bikos of one relijos katakata, Victor Arikoro bin start im own ministri for May 9, 1990.[1][2] Today, im chorch headkwotas dey for Warri, Delta Stet, Naija.[3] Na im bi mentor to orda pastors for im chorch, including Paul Eyefian. Isaiah Ogedegbe don kol am "a veri hombo man of God wit di betalicious milk of di Word".[1]

Ministri an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

As pesin wey God don kol to prish, tish an diliva pipul wey devil don tie down, Victor Arikoro dey run a Pentikostal Kristen ministri wit programs for di televishon wey dem dey kol: "Maranatha Hour", wey dey show for Delta Rainbow Televishon, Warri.[1] E dey also run a Bibol skul wey dem dey kol: "Maranatha Bibol Kolej", wey bi di training arm of di Pentikostal Afrikan Chorch.[2] E dey also run di PAC Nurseri an Pramari Skul, Warri.[4]

Pasonal laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Egbo-Uhurie (wey dey for Ughelli Saut Lokal Govamet Aria of Delta Stet, Naija) dem tek bon Victor Arikoro an dis one mek am Urhobo man.[1][4][5] E don mari wit pikins-dem an e dey live for Warri, Delta Stet, Naija.[1][2][4]

How dem tek kari im nem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Victor Arikoro bin rait sey mek poor pipul build gud soshal rileshonship wit rich pipul bifor di taim of nid.[5][6] Dem leta compare wetin e rait wit Nkem Owoh's song.[7] For 26 March 2023, Isaiah Ogedegbe bin rait sey akording to "both Akbishop Arikoro an Nkem Owoh tok", gud soshal rileshonship bitwin rich an poor pipul bifor di taim of nid na key to betalicious laif.[7]


Victor Arikoro nem don show for meni intanet online websaits bikos of im ministri work as a man of God.[8][9][10]

[11] [12]

One undergraduate studet of di Univasiti of Bini (Politikal an Poblik Administreshon), Ruona Oghuvbu, for im 2015 Bashilor's thesis, bin menshon di nem of Akbishop Dr. V. E. Arikoro, as e dey prez am for im soport.[13]


Im chorch nem enta nius for 2017 wen di Pentikostal Afrikan Chorch youths an tinejas bin selibrate dia thanksgiving for insaid im chorch headkwotas for Warri.[3]

Buks[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pikshor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. 1.0 1.1 1.2 1.3 1.4 1.5 1.6 1.7 Isaiah Ogedegbe (13 January 2022). "Happy Birthday! Archbishop Dr. V. E. Arikoro (JP) Is 80 Years Old Today". Opinion Nigeria. Archived from the original on 13 January 2022. Retrieved 17 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 2.0 2.1 2.2 2.3 "ARCHBISHOP DR. V.E. ARIKORO JP". PAC.org.ng.
  3. 3.0 3.1 Isaiah Ogedegbe (4 October 2017). "Day PAC youths, teenagers celebrated their thanksgiving in Warri". Blank NEWS Online. Retrieved 17 December 2023.
  4. 4.0 4.1 4.2 4.3 4.4 "V. E. Arikoro". NigerianWiki.com. Archived from the original on 2023-12-18. Retrieved 2023-12-18.
  5. 5.0 5.1 5.2 5.3 Chris, David (16 February 2018). "God At Crucial Moment: A Look At One Of Urhobo's Adages - Book Written By Dr Victor Arikoro". Ngyab.com. Archived from the original on 16 August 2018. Retrieved 17 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  6. Arikoro, Victor E. (2008). God At Crucial Moment. Warri: Gina-Daf Prints. p. 2. ISBN 978-033-932-9.
  7. 7.0 7.1 Imoh, Jennifer (26 March 2023). "The Rich and the Poor: The Place of Social Relationship in the Amelioration of the Human Condition -By Isaiah Ogedegbe". BreakingNews Nigeria. Archived from the original on 2 April 2023. Retrieved 19 December 2023.
  8. Odidi, Godday (20 March 2013). "MOSES OGBODOGBO AT 10". ModernGhana.com. Archived from the original on 21 March 2023. Retrieved 17 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  9. "Nigeria will not break up 'Bebor". LatestNigerianNews.com. 19 October 2014. Archived from the original on 21 March 2023. Retrieved 17 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  10. Joel, Grandball (21 December 2017). "Two Americans, 13 others bag Ughievwen titles as monarch marks 6 years on throne". PoliticsGovernance.com. Archived from the original on 25 September 2023. Retrieved 17 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  11. Atevure Princess (30 November 2017). "Waive's aspiration receives a boost; Urhobo Christian Ministers adopt him as their candidate". Advocate.ng. Archived from the original on 21 March 2023. Retrieved 2 January 2024.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  12. Ogwara, Blessing (9 June 2021). "How God saved me from untimely death - Emiaso". IMirror Online. Archived from the original on 21 March 2023. Retrieved 2 January 2024.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  13. Ruona Oghuvbu (2015). "BOKO HARAM AND INSURGENCIES IN NIGERIA: A CASE STUDY OF THE NORTH EAST REGION". Academia.edu. Retrieved 2 January 2024. I go luv to say a big thank you to Akbishop Dr. V. E. Arikoro, Bishop E. A. Ekpekurede, my Pastor, Fej Okpilolo; you don bikom a source of strength and inspireshon. Thank you for ur soport.

Extanal links[chenj-am | chenj-am for orijin]