Nkem Owoh

From Wikipedia

Nkem Owoh na naija aktor an komedian. For 2008 e win di afrika muvie akedemi awod for best aktor for lidin a role for one naija fim wey bi Stronger than Pain.

[1] E bi one of di "A-list aktors fom Naija fim indostri, Noliwood.[2]

Nkem Owoh

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Enugu Stet inside Naija dem bon am for 7 Febuari 1946. Afta e finish im primary an sekondri skul, e kon go federal univasiti of Agriculture, Abeokuta an stodi engineering. Na fom im univasiti taim im don stat to dey akt.

Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem know am for im song wey bi "I Go Chop Your Dollar" abaut fraud. Dem sing di song for insaid one fim wey bi The Master wey Owoh akt like a skamar. The Economy and Financial Crimes Commission an di Nigeria broadcasting komishon ban di song. For 2007, dem arrest Owoh in Amsterdam, Netherland bikos of seven months investigeshon kari out by Dutch polis dubbed Operation Apollo. Polis ares Owoh wen e dey paform a muzik show, Di polis dem dem enta di event senta an also arrest 111 pipul bikos dem dey suspet dem for lottery fraud an immigration violation. Dem leta rilis Owoh. In 2009 dem kidnap Owoh in eastern part of Naija. Im kidnapa want 15 million naira bifor dey will rilis am. But na 1.4 million naira im famili pay dem bifor dem rilis am.


Dem also know am for im song wey bi "Know Me Wen Am Poor" abaut soshal rileshonship.[3] For 26 March 2023, Isaiah Ogedegbe bin rait say akording to "both Akbishop Arikoro and Nkem Owoh tok", gud soshal rileshonship bitwin rich and poor pipo bifor di taim of nid na key to beta laif.[3]

Fim wey e don akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

• Things fall apart (1987)

• Circle of Doom (1993)

• Rattlesnake (1995)

• Ukwa (2000)

• Big Man....Big Trouble (1999)

• Sawam (1999)

• Conspiracy (1999)

• Onye Eze (2001)

• Fake Doctor (2002)

• Ifeonyi Metalu (2002)

• Long John (2002)

• Police Officer (2002)

• King of the forest (2002)

• Lion finger (2002)

• Anunuebe (2002)

• Spanner (2002)

• Mr Trouble (2003)

• Osuofia in London (2003)

• Police Recruit (2003)

• America Visa (2003)

• My Driver (2003)

• My Own Share (2003)

• Osuofia in London (2004)

• Spanner Goes to Jail (2004)

• The Master (2004)

• Akanchawa (2004)

• Bus Driver (2005)

• The Prince (2005)

• A fool at 40 (2005)

• Captain (2005)

• Foreign Base (2005)

• Indemnity (2005)

• Made in Cambridge (2006)

• My Kingdom Come (2006)

• The Barrister (2006)

• The Dreamer (2006)

• Battle of Indemnity (2006)

• Covenant Keeping God (2006)

• De Prof (2006)

• Johnbull & Rosekate (2006)

• Persecution (2006)

• Stronger Than Pain (2007)

• His Holiness (2008)

• His Last Action (2008)

• Wonderful Man (2008)

• Military Zone (2012)

• Ghana Must Go (2015)

• Lion hearts (2018)

• Kpaii (2019)

• My Village People (2021)

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "AMAA 2008 Winners". African Movie Academy Award. Archived from the original on 2022-05-28. Retrieved 2023-03-27.
  2. Biakolo, Kovie (6 November 2019). "Nigeria's 'Lionheart' disqualification is bigger than the Oscars". Cable News Network. Archived from the original on 6 October 2022. Retrieved 26 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. 3.0 3.1 Ogedegbe, Isaiah (26 March 2023). "The Rich and the Poor: The Place of Social Relationship in the Amelioration of the Human Condition -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. Archived from the original on 26 March 2023. Retrieved 26 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)