University of Ilorin

From Wikipedia

University of Ilorin wey pipul sabi as Unilorin na fediral govament yunifasiti wey dey Ilorin, Kwara Stet inside Naija.Na for August 1975 dey kret di skul wit a dikri of di fediral militri govament.Dey fom di skul so dat meni Naija populashion wey get plan to go yunifasiti go fit go an sey di skul go train Naija studet so dat dey go fit hep wok for ekonomi of di kontri to beta. Wit all di hiya institushion wey dey Naija, na Unilorin big pass bikos e land na 15,000 akas of land. For 2021, JAMB tok sey na Unilorin pipul like to go pass.

Tori abaut di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di yunifasiti fest stat as smol pat as Yunifasiti kolej wey dey pat of University of Ibadan.Dr T.N Tamuno wey bi professor an hed of Histri Dipatment for University of Ibadan bi di fest prisipal of di kolej in September 1975. Wen December 1975 rush, Dr Tamuro don bi di Vais- Shansellor for di yunifasiti of Ibadan. Bikos of dis one, dey kom chenj di prisipal of di kolej to Professor O.O. Akinkugbe in 1975.Akinkugbe bi di hed of Falkoti of Medisin, yunifasiti of Ibadan bifor e go di kolej.Akinkugbe find hep go di sekond Militri govno of Kwara Stet, di late Korne Ibrahim Taiwo so day di govno go fit sopot di skul to stand wel wel.Akinkugbe stil find hep go di nomba 3 Miliri govno of di Stet, Brigediya George Agbazika Innih wey komot land fom di land of Kwara State College of Technology giv di Yunifasiti. For October 1977, di yunifasiti kom fit stand wel wel an Professor O.O.Akinkugbe kom bi dia fest Vais-Shansellor. Na onli 200 studet stat di skul on 23 October 1976 as dey pass di entrans ezam an tishin stat on 25 October 1976. Na onli 3 falkoti di yunifasiti tek stat wok: Falkoti of Art, Falkoti of Sayens an Falkoti of Edukeshion.Wen dey stat na for tempoari Kwara State Polytechnic kampos dey fest dey yuz an dey kol di kampos mini-kampos.Na di mini-kampos all di tishin Program of Falkoti of Art, Sayens, Edukeshwon, Enjiniarin an Tekinoloji, Biziness an Soshial Sayens an Bezik Klinika Sayens seshion of di Health Sayens Falkoti. Na dis mini-kampos dem dey yuz ontil January 1982 wen dem kari ova 1000 Sayens studet go di pamanet site. In 1982, dem don finish di niu falkoti blok an ples for Nashoral Sayens an Enjiniarin site. In 1983, dey stat di law programs onda di falkoti of Bizness an Soshial Sayens. In 1993, di law Dipatment kom get e own ples too. University of Ilorin' get 15 falkoti an ova 60 dipatment.Di falkoti bi:

  • Art
  • Agriculture
  • Environmental Sciences
  • Life Science
  • Management Science
  • Physical Sciences
  • Social Sciences
  • Communication and Information Sciences
  • Education
  • Engineering and Technology
  • Pharmaceutical Scieces
  • Veterinary Medicine
  • Law
  • Basic Medical Sciences
  • Clinical Sciences (the last two falkoti dey onda University College of Health Sciences)

Di yunifasiti stil get two Institu:

  • Institute of Education
  • Unilorin Sugar Research Institute an meni postgraduate skul.

Di yunifasiti stil get som Sentral like:

  • Centre for Ilorin Studies
  • Centre for Peace and Strategic Studies
  • Ilorin Business School an so on.

Vais-Shansellor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yunifasiti of Ilorin don get meni Vais- Shansellor bot di fest Vais-Shansellor wey bi sey na di yunifasiti e sef go na Ishaq Oloyede. Di folorin na nem of all di Vais-Shansellor an di year of ofis

  • Professor O.O.Akinkugbe (1975-1978) Sekod prisipal an fest Vais-Shansellor
  • Prof. A. O. Adesola (1978–1981)
  • Prof. S. A. Toye (1981–1988)
  • Prof. A. Adeniyi (1985–1992)
  • Prof.J.O Oyinloye (1992–1997)
  • Prof. S. O. Abdulraheem (1997–2002)
  • Prof. S. O. Amali (2002–2007)
  • Prof. I. O. Oloyede (2007–2012)
  • Prof A. G. Ambali (2012–2017)
  • Prof. Sulyman Age Abdulkareem (2017–2022)
  • Prof. Wahab Egbewole(2022–)

Popula pipul wey go di yunifasiti[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Femi Adebayo- Nollywood aktor
  • Ezekiel Adebiyi- Presidor Nigerian Society of Bioinformatics and Computational Biology

Pius Adesanmi- professor an columnist Ifedayo Adetifa- Daretor jenerel, Nigeria Centre for Disease Control

  • Abdulfatah Ahmed, forma Kwara State Govno.
  • Sarah Alade, banka, forma aktin Govnor of Central Bank of Nigeria.
  • Salamat Ahuoiza Aliu- fest wuman neurosurgeon in West Afrika
  • Jekwu Anyaegbuna- raita an poet
  • Charles Ayo, forma bá vais-shansellor Covenant University.
  • Ado J. G. Muhammad- datetor, National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA).
  • Abdul Rasheed Na'Allah- vais-shansellor, Kwara State University
  • Aize Obayan- forma vais-shansellor, Covenant University and Landmark University.
  • Josephine Obiajulu Odumakin, wumen rights activist
  • Temi Olajide- child/sleep training consultant
  • Johnson Bamidele Olawumi, former Director General, National Youth Service Corps.
  • Is-haq Oloyede, the university's first alumni vice chancellor, Registrar Joint Admissions and Matriculation Board

Nkem Owoh, comedian.[17][18] Notable faculty John Omoniyi Abiri, Nigerian academic, the first Head of Department and dean of the Faculty of Education