Kayode Adebowale

From Wikipedia

Kayode Adebowale (Dem bon am for January 11, 1962) na Naijá scientist wey bi di niu Vice-Chancellor of di 'University of Ibadan, Oyo State.

How e tek stat life an go Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am on 11 day of January, 1962 inside famili of late Mr. and Mrs. Adebowale Esuruoso. Im go pamari Skul for St. Marks Primary School, Oke-Ijaga, Ijebu-Igbo fom 1967 enta 1972 afta wey im kom go dj im sekondiri edukashion for Ayedaade Grammar School, Ikire fom 1973 enta 1978. Afta Adebowale finish sekondiri Skull, im fom dia enta University of Ibadan for September 1980, na dia im kom get B.Sc degree inside Chemistry for June 1984; M.Sc degree inside Industrial Chemistry for September, 1985, kom join Ph.D inside Industrial Chemistry for October, 1991.

How e tek work[chenj-am | chenj-am for orijin]

Professor Adebowale bin stat work inside University of Ibadan as Graduate Assistant for 1987 enta 1991. For October 1991, e see work for Federal University of Technology, Akure wey dem bin giv am Leshora II, kom promot am enta di grades of Leshora I for 1994 plus Senior Leshora in 1997.Adebowale kari transfa tek kom bak to University of Ibadan for February 1999 as Senior Leshora an na so dem kom tek promot am enta di grades of Reader for 2003 and Professor for October 2006.

Professor Adebowale bin hold plenti plenti administrative posts as im don wok inside meni komitees for University of Ibadan. Dem be Examinations Officer, Department of Chemistry, 2003-2005; Postgraduate Coordinator, Department of Chemistry, 2000 – 2002; Sub-Dean (Postgraduate), Faculty of Science, 2002-2004; Dean, Faculty of Science, 2009-2011; Member, Komitees of Provosts and Deans, 2009-2011; Member Komitees on di Appointment of Emeritus Professors, 2012 to date. The Director, Special Duties, Office of the Vice-Chancellor, between 2015 and 2016.

Awards wey im don win[chenj-am | chenj-am for orijin]

Professor Adebowale don win plenti plenti awods wey inklud: Fellow, Nigerian Academy of Science, FAS 2012; Fellow of di Institute of Chartered Chemists of Nigeria, FICCON, Research Fellow, Alexandra von Humboldt Foundation, Germany 1996 to date; Regular Associate, Abdus Salam International Centre for Theoretical Physics, (ICTP) Trieste, Italy, 2003-2006; recipient, International Foundation for Science (IFS) Grant, 2002-2004; and recipient, African Union Kwame Nkrumah Continental Scientific Award for Science, Technology and Innovation, 2013.

Achievements[chenj-am | chenj-am for orijin]

As im wan promote original research inside Chemical Sciences among young scientists for Nigeria, Prof. Adebowale come put for ground two awards in 2014 for people wey bi members of di Nigerian Young Academy (NYA): Prof. Kayode Adebowale National Scientist Prize for Wumen in Chemical Sciences and Prof. Kayode Adebowale National Scientist Prize.

Professor Adebowale bí ogbonge akada man wey don do external examiner for meni universities for inside Naijá an abroad. Universities wey Adebowale bin dey do external examiner include Federal University of Technology, Akure; Federal University of Agriculture, Abeokuta; Delta State University, Abraka; Olabisi Onabanjo University, Ago-Iwoye; Federal University of Technology, Yola; Bells University of Technology, Ota; Ladoke Akintola University of Technology, Ogbomoso; Vaal University of Technology, Vanderbijlpark, South Africa and University of Botswana, Gaborone.

Professor Adebowale bi reviewer of plenti international journals wey include: Journal of Hazardous Materials; Chemistry and Ecology; Food Research International; Journal of Food Composition and Analysis; Thermochimica Acta, Biochemical Engineering, Carbohydrate Polymers, Agriculture and Food Chemistry; International Journal of Biological macromolecules and Starke.

Im bi representative for Physical Sciences group inside di kouncil of di Nigerian Academy of Science for 2016 enta 2018 kom bi oga Chairman for Chemical Society of Nigeria (CSN), Oyo State Chapter for 2016 til now.

As ogbonge acada wey im bi, im don supervise plenti plenti B.Sc projects, M.Sc dissertations wey don pass 150 come join 15 doctoral students. Im don publish articles wey pass 120 for inside koret local an international journals, kom get one patent wey him don register.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Professor Adeboye du marej with Dr. ‘Yemisi Ajibola Adebowale anbGod don bless di marej wit three pikin: Temitayo, Ayobami an Ayomitunde.