Tunde Onakoya

From Wikipedia
Tunde Onakoya
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Fest nemTunde Chenj-am
Famili nemOnakoya Chenj-am
Wen dem bon am6 October 1994 Chenj-am
Ples wey dem bon amIkorodu Chenj-am
Wok wey e dey duchess player, activist, chess coach Chenj-am
Wie e go skulYaba College of Technology Chenj-am
Academic degreediploma Chenj-am
Academic majorcomputer science Chenj-am
Sportchess Chenj-am
Owner ofChess in Slums Africa Chenj-am
Significant eventGuinness World Records Chenj-am

Tunde Onakoya (dey bon am 6 October 1994) na Naija pesin wey sabi play chess game an e sabi tish pipo abaut di game. Na Onakoya bi di fest pesin wey play chess game for Fifti-Eight hours with out restin. Onakoya bi di fonda of Chess in Slums Africa. E dey always tok abaut wetin poor pikin-dem dey sofa as e don tok abaut dem in Legos Stet. Di aria of Legos Stet wey e don tok about di problem na Ikorodu, Makoko an Oshodi. For dis aria, Onakoya go tish dem how to play chess game an how to rid an rait for two-wik.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 6 October 1994 dem bon Tunde Onakoya. Na for Legos e tek do e smol pikin. Na for one barba shop wey de Ikorodu for Legos Stet e tek sabi how to play chess game. Onakoya mama poor sotey e no fit pay di sekondri skul moni for e pikin to fit go skul. Bikos of dis, e mama gree mek im dey klin di skul kompand so dat Onakoya go fit dey go di skul. Leta in life, Onakoya kom bi di nomba 13 pesin wey sabi play chess game pass for in Naija.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Onakoya get Diploma digri in Komputa Sayens from Yaba Kolej of Edukeshon. Wen e still dey di skul, Onakoya kari fest for di Nigeria Politenik Game. Onakoya still kari fest for Chess Game kompetishon wey RCCG organise. Oda Chess Game wey e don kari fest na: Nashonal Friend of Chess, an Chevron Chess Open. Onakoya don tok inside CNN Africa Voice bifor. E de one of di memba wey dey supavais one organisashon wey di nem na The Gift of Chess. Dat organisation na free organisashon wey evri bodi fit join.

On 20 April 2024, Guiness buk of rekod give Onakoya awod as di onli pesin wey play chess for ova 60 hours without restin.