Toyin Afolayan

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Toyin Afolayan (dem bon am for September 24, 1959) na Naijá fim aktres wey dem stil no as Lola Idije.E bikom popula afta e akt as Madam Adisa for di fim wey dem kol Deadly Affair for 1995.

Na Toyin Afolayan stat di slang "Soro Soke were" an "Pele My Dear" . "Soro Soke Were" na di slang wey #EndSars protesta-dem yuz for Naijá to mek Naijá Govament stop SARS Police unit wey dey trit pipu eni how for di kontri.

Tori of e laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Toyin Afolayan kom from Agbamu, Kwara Stet for South West Naijá.E bi kosin of Adeyemi Afolayan (aka Ade Love) an anti to Naijá fim aktor-dem Kunle Afolayan, Gabriel Afolayan, Aremu Afolayan and Moji Afolayan. Toyin stat to akt in di '80s bikos of Ade Love e kosin.Toyin stil dey akt for Nollywood til now an na for Yoruba fim-dem e dey akt pass.

E pasona laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Toyin Afolayan na widow, mama of three wuman pikin-dem an grama. Toyin onli son don dai wen e dey smol.