Tope Alabi

From Wikipedia

Tope Alabi (Dey bon am for 27 October 1970) na Naijá gospel singa, fim muzik podusa an aktress. Pipu no am as Ore ti o common an Agbo Jesu

Tori Abaut Her Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Alabi on 27 October 1970 in Legos Stet, for Naijá.Im papa na Joseph Akinyẹle Obayomi an Im mama na Madam Agnes Kehinde Oloyede bayomi. Alabi na di ol wuman of di tiri pikin wey Im papa an mama bon.Alabi papa kom from Yewa, Ogun Stet.Shi go Oba Akinyẹle Memorial High School, Ibadan. for her sekondiri skul an rite WAEC in 1986. Alabi rid Mass Kominikashon in Politeknik Ibadan an kolet Sirtifikate in 1990. Alabi bifo na memba of the Jesters International Comedy group.Shi wok wit oda popula grup wey dey do stage play in Ibadan an Legos. Alabi mek fim for yoruba langwej for Nollywood.Tope Alabi kom stat to dey sing kristian afta shi bekon bon-egain Kristian. Naijá pipul for twitter chuz Tope Alabi as kween of Yoruba langwej for di konpetishon wey United Bank for Africa do on their 70 annivasiti selebreshon on 13 Juin 2021.Pipul yab-am for wetin shi tok abaut wan muzik wey di nem na Oniduro Mí.Tope Alabi na marid wuman an shi get tu pikin.

Ol Her Muzik[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Ore ti o common (2001)
  • Iwe Eri (2003)
  • Agbara Re Ni (2005)
  • Agbara Olorun (2006)
  • Angeli Mi (2007)
  • Kokoro Igbala (2008)
  • Kabiosi (2010)
  • Moriyanu
  • Agbelebu (2011)
  • Alagbara (2012)
  • Agbelebu (2013)
  • Oruko Tuntun (2015)
  • Omo Jesu (2017)
  • Yes & Amen (2018)
  • Spirit of Light (TY Bello) 2019
  • Adonai (TY Bello)
  • Awa Gbe Oga (TY Bello)
  • Angeli (TY Bello)
  • Olorun Nbe Funmi (Iseoluwa)
  • Erutetoba (TY Bello)
  • No one else ( TY Bello)
  • Olowo Ina (TY Bello)
  • War (TY Bello)