Tonto Dikeh

From Wikipedia
Tonto Dikeh
pesin
Industryfilm industry, cinema of Nigeria, entertainment industry Chenj-am
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am6 June 1985 Chenj-am
Ples wey dem bon amRivers state Chenj-am
Wok wey e dey duactor, singa Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulRivers State University of Science and Technology Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
Wen e stat wok2006 Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimcontemporary R&B Chenj-am
Official websitehttps://www.tontodikehent.com Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Tonto Charity Dikeh (dem bon am on 9 June 1985) na Naija aktres,singa, songraita, an e lik to dey hep pipu. On 27 August 2000, e stat foundashon, "The Tonto Dikeh Foundation".Insaid June 2022, na Tonto Dikeh bi di deputy govnor candidate onda di Afrika Democratic Congress insaid di 2023 Rivers Stet gubernashonal eleshon. Port Harcourt pipu lik am for wetin e du.

Muvie an televishon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tonto Dikeh dey insaid muvie wey bi Dirty Secret, wey difren pipu tok abaut am bikos of di bad tins wey hapun insaid. As som pipu dey tok sey e no du lik beta Afrika pikin for di muvie, an som pipu dey tok sey na im wok shi dey du.

Muzik wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ontop hau shi tek popula for fim, Tonto Dikeh kon go du muzik wok. Bifor dat one e don du muzik video for Amaco Investments, wit Patience Ozokwo. Shi du fest album wey e kol "Hi" an "It's ova" wey shi du wit snypa. On 13 June 2014, Naija singa D'bang sign to im rekod label, DB Rekods. Tonto Dikeh Tel pipu sey e dey komot for di rekod label in March 2015.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Tonto Dikeh insaid famili of seven an na im bi third pikin insaid five pikin wey dem bon. Im famili na fom Obio- Akpor, one Lokal govt aria for Rivers Stet, south-south Nigeria an shi bi Ikwere pesin. Wen shi dey 3 years old, im mama kpai wey kon mek anoda mama wey dia papa mari train am, wey get two pikin. Dikeh stodi Petrochemical Engineering for Rivers State University of Science and Technology. Insaid September 2021, Tonto Dikeh's hosband bifor, Prince Joseph Kpokpogri, kari am go kourt andi Department of State Security (DSS) bikos dem no du wetin bi im raight for am. Kpokpogri tok sey e no wan mari Tonto Dikeh bikos of di kain way shi dey smoke an drink.

Katakata wey hapun[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi du tradishonal marriage wit Olakunle Churchill on August 2015. Insaid 2014, tok tok tori wey pipu dey kari we ear sey shi an Rukky Sanda dey sleep togeda. Wen Rukky Sanda dey tok for intavew shi tok sey no bi tru tok. Insaid February 2016, Tonto Dikeh bon one boi wey dem kol am 'King', som stil sabi di boi as Baby X. Dia two no dey togeda again. Dikeh for 2021 dey for one katakata wey hapun wit im hosband, shi tel pipu sey im bifor bifor hosband, Joseph Egbri (wey plenti pipu sabi as Prince Kpokpogri) du video wit Usiwo Orezimena Jane, wey dey holways dans,plenti pipu sabi as JANEMENA, wen dia two dey sleep togeda. Dikeh tok dis one wen dia two no dey again.