Timi Dakolo

From Wikipedia
Timi Dakolo
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemTimi Chenj-am
Wen dem bon am20 January 1981 Chenj-am
Ples wey dem bon amAccra Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Port Harcourt Chenj-am
Wen e stat wok2007 Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimsoul music Chenj-am

Timi Dakolo na Naijà singa, song raita an muzik Produsa. Na im win Idols West Afrika Insaid 2007. Som tins wey folo di win na rekod label wit Sony BMG.

Hau e tek stat life an im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na fo Accra, Ghana dem bon Timi Dakolo to Naijà man, wey kom fom Bayelsa an im mama na fom Ghana. Timi Dakolo mama, Norah Kimmy Head, die Wen e dey smol. Na Ghana dem bon am but na im mama an aunti fo Portharcourt, e sta wel wel. Im tok say na im aunti Susan Larry, fest dey tich am hau to sing.

Timi stat to dey sing wen e dey twelve years. Insaid 2013, e join Purple Love wey bi music grup. Plenti pipul sabi di grup fo Portharcourt, but di grup kon skata as all memba go University of Port Harcourt. Timi Dakolo win lokal competition wey bi G.E FACTO, wey dem du fo Port Harcourt.

Hau e tek win Idols West Afrika[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid 2006, Timi Dakolo go for Idols West Afrika in Calabar, Cross River Stat of Naijà. Timi sing Lemar's Time to grow song fo dia. Di pipul wey dey giv mark lik di way wey e sing Wel wel, wey mek dem tok say e fit win am.

Wen di Idols West Afrika dey go, Timi Dakolo no dey fo di las 3 wey fit komot. Insaid all di week wey dem tek du di sho na Timi vote dey plenti Pas.

Na wen e dey di competition im mama die, but e stil kountiniu wit di sho.Bifor Timi go fo Idols West Afrika e don dey go Skol fo University of Port Harcourt.

Afta Idols[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Timi don win Idol West Afrika 2007, fo January 1, 2008, New year day, dem shot am fo Presidential Hotel wey dey Port Harcourt. E go do chorch tins fo di hotel wit im frends. No bi Dakolo dem won shot bullet jus touch am. One Gate man die fo di plez, Timi no die but e get wound for bodi, dem kari am go hospital an e kom bak dat day.

Timi rilis im fest three songs insaid 2009.

Fo 2011, Timi rilis anoda song wey bi There's a Cry. Na for Naijà dem du di musik video. Na Lone Rekord/Now Muzik im sign for.

Timi Dakolo dey Insaid dey pipul wey dey giv vote fo Di Voice Nigeria.

Timi Dakolo rilis Christmas album wey e kol "Merry Christmas, Darling" wit artist lik Emeli Sandé an Kenny G Insaid November 2019.

Im pasonal lif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Timi Dakolo mari Busola Dakolo (nèe Amupitan) fo 2012. Dey get three pikin.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Albums

. Beautiful Noise (2011)

. Merry Christmas (2019)

Singles

. There's a Cry (2011)

. Great Nation (2011)

. Iyawo mi (2014)

. Wish me well (2015)

. The Vow (2016)

. Medicine (2017)

. I Never know Say (2018)

. Merry Christmas Darling (2019)

. Take ft Olamide (2020)

. Everything [Amen] (2021)

Awods an Normination[chenj-am | chenj-am for orijin]

. 2010 Norminee:Hip Hop World Normination of the Year-[Headies]

. 2015: Best Recording Artist.of the year- Wish me well