The Golden Arm

From Wikipedia

The Golden Arm na one tradishonal old tori wey de meni kolsho. For meni kolsho, pesin dey hie dis tori from one pesin to anoda, no bi sey dem rait am down for pepa. Na Mark Twain mek "The Golden Arm" tori popula wel wel an e yuz am tish pipo mentod wey dem fit yuz to tok eni tori. Di tori na abaut one pesin wey get gold arm wey jos kpai. Bikos of sey di dead pesin get gold arm, pipo dey always tiff dis arm. Di pipo wey dey do am wel wel na di dead pesin famili memba. Na bikos di pipo dey greedi dey kos dis one. Di dead bodi go kom back kom dey find im hand wey tiff don kari go. Dis one dey mek di tiff riton di hand back bikos of fear-fear. Most of di time, na pesin dey yuz e mouth tok dis tori no bi sey e dey rid am. Afta e wan finish di tori di pesin go kom shout so dat pipo wey dey hie am go fit fear.

Di orijin of do tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dokumet wey de show sey "The Golden Arm" tori don de for ova 200 years. Infact, pipo don dey tok dis tori now for ova 200 years wey di dokumet show [03-31, 18:15] Mon Pefi: Dis tori na part of di Aarne-Thompson Type 336 wey mins sey a dead-bodi fit kom back life kolet wetin pipo tiff for e hand. Dis tin wey dem tiff fit bi one part of e bodi, e diress, an eni of e propati.

Di tori idiya bi sey, pesin or hanima wey don kpai no go fit rest wel wel onti evri part of e bodi komplet finish as e bi bifor e kpai Pipo dey tok dis tori bikos dem wan yuz am tish pipo wey dey lisin to get respet for dead-bodi. Afta somtime, di tori kom bi di one wey pipo dey yuz tish wetin greedi fit kos.