Teqball

From Wikipedia
Teqball_jatek

Teqball na ball sport wey dem dey pley on top teble wey kurf, na two tins togeda di sport get sepak takraw an table tennis. Di playa fit uze eni of im bodi pley di sport apat fom im arms an hands. Two playas fit pley Teqball as one game, four playas fit pley am as double game. Di pipu wey dey in charj for di wod na International Football of Teqball (FITEQ). Som ogbonge futbola like di game, an dem dey insaid som of di event for di 2021 Asian Beach Games an di 2023 European Games, dem dey try put am insaid Olympic games.

Teqball na sport wey pipu sabi fas fas pas in August 2018 bikos dem sabi di pipu wey dey in cherj FIFEQ by Olympic Committee of Asia (OCA). In June 2019 Association of National Olympic Committee (ANOCA) sabi dem.

In November 2020 Global Association of International Sports Federation (GAISF) giv dem dia full memba.

Histri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Teqball fest stat in 2012 in Hungary by three pesin wey lik futbol wel wel: bifor bifor ogbonge playa Gábor Borsányi [hu]; Hungarian Biznesman György Gattyán; an komputa pesin Viktor Huszár. Pesin wey tink am na Gábor Borsányi, wey dey pley bol on top teble tennis teble. Hau Dem du di teble tennis teble no dey let am bounc to di playa, so Dem no enjoi di game. Borsányi kon tink am sey if di teble bend smol e go dey bounc wel to di playa, an e go dey eazi to pley wit leg. Afta som years dem du dia own teble for Teqball wit Viktor Huszár, in 2014.

Dem sho di wod di game for Budapest, Hungary on October 18, 2016, by bifor bifor Brazilian playa Ronaldinho.

Rules[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di rules wey dem go folo dey for FITEQ's rules.

Som of di rules

. Dem fit pley teqball wit bols wey dem dey uze pley footbol, wit size five wey dey offishial.

. Two playas fit pley teqball (Single game) or by four playas (double games)

. Komplete Teqball match dey get best-of-three-set.

. Na wen one playa/team don get 12points bi one set.

. Evri plays/team go get chanc to serv two times.

. Di playa/team dey chenj servifis afta e get four points.

. Dem no gree for eni playa mek e torch bol wit d sem pat of im bodi two times.

. Dem no gree mek u pley bak di bol to oda playa/team wit di sem pat of di bodi two times.

. Playa/team fit torch di bol 3 times wit eni pat of im bodi bifor dem pley am bak to di sekond playa/team, dem no gree mek eni playa uze hand an arm.

.For doubles, a team fit torch di bols 3 times, but e must pas am di bol once to oda team memba.

. Wen dem dey pley, dem no alow eni memba mek e torch teble or oda playa wey dem no dey sem team.

. Wen ball na edgebol, dem go re-pley am


Dia wok an properti[chenj-am | chenj-am for orijin]

Teqball no bi lik oda sports, di Kain way wey dem uze du dia Teqball teble, na onli Teqball Internashional abi oda kompini wey Teqball Holding SARL tel to mek tebles get rait to dey mek am. Di nem "teqball", na onli pipul wey dem giv rait fit uze am for poblic abi uze am sel maket. Dem du hol di law bikos dem wan mek di sport gro.

Kompetition[chenj-am | chenj-am for orijin]

Teqball World Championship

Di Teqball World Championship na wetin dem dey du evri year wey FITEQ dey in cherj.

Di Teqball kompetishion get single an double dor man an wuman. Di fest wod Teqbal Championship hapun for Budapest, Hungary 2017 wey kontri wey pas 20 dey insaid. Di one wey dem du for 2018 hapun for Reims France wey 90 playas gada pley insaid.

Di 2019 Teqball World Championship hapun for 6-8 December 2019 insaid Budapest. E rich 160 sport pipul wey kom fom 58 kontris pley insaid single, double an mixed double games.

FITEQ tok sey dem no go du di kompetishion for 2020 Teqball World Championship bikos of COVID-19 wey dey dat time.

Afrika Beach Games[chenj-am | chenj-am for orijin]

Teqball dey for fest Afrika Beach Games in Sal, Cape Verde on 14-23 July 2019. Na Cameroon win di kop wen dem beat Nigeria for final.

Asian Beach Games & Asian Indoor and Martial Arts Game (AIMAG)[chenj-am | chenj-am for orijin]

As sport wey Olympic Council of Asia (OCA) sabi, teqball dey insaid di game wey dem go du for Sanya 2020, but di Olympic Council of Asia (OCA) don shift di Sanya Asian Beach Games, wey dem sorpos du for 2-10 April 2021. Na OCA Executive Board mek am bi lik dat, bikos of COVID-19.

Di OCA, Di National Olympic of Thailand an di AIMAG 2021 organising Committee don gree dey di event, wey teqball go dey insaid di sport wey dem go du, go hapun for 10 to 20 March 2022. Di OCA don dey folo Chinese Olympic Committee an di Sanya Asian Beach Games Organising Committee tok sey mek dem gree niu date for di 6th Asian Beach Games, wia teqball go fest dey as sport wey go folo Kolet pris wey dem giv for neck.

European Games[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di European Olympic Committee (EOC) don folo FITEQ tok sey teqball go dey for di fest time insaid European Games in 2023 arenjmet.

Wod arenjmet[chenj-am | chenj-am for orijin]

FITEQ get wod arenjmet for singles, doubles an Mixed doubles, na hau dem tek du wel for hol FITEQ events dem dey use kakulate di points. Dem dey gada points wey dem get for dem evri time, na im dem dem tek sabi number 1. Di las one na:22 February 2022:

Place Singles Points
1. Ádám Blázsovics 41977
2. Györgydeák Apor 38693
3. Julien Grondin 26696
4. Anna Izsák 20719
5. Csaba Bányik 15798
6. Adrian Duszak 15660
7. Paulina Łeżak 11912
8. Bogdan Marojević 10380
9. Hugo Rabeux 10358
10. Balázs Katz 10192
Place Doubles Points
1. Csaba Bányik 42575
2. Ádám Blázsovics 42049
3. Nikola Mitro 40072
4. Szabolcs Ilyés 38634
5. Bogdan Marojević 38632
6. Dennis Correia 38530
7. Apor Györgydeák 37772
8. Luka Pilic 37477
9. Hugo Rabeux 28877
10. Julien Grondin 28877
Place Mixed Doubles Points
1. Csaba Bányik 32018
1. Zsanett Janicsek 32018
3. Vania Moraes da Cruz 17008
3. Leonardo Lindoso de Almeida 17008
5. Nikola Mitro 15372
5. Maja Umićević 15372
7. R Apor Györgydeák 13944
8. Vania Moraes da Cruz 12792
8. Leonardo Lindoso de Almeida 8268
10. ROM Tünde Miklós 8268