Teni

From Wikipedia

Teniola Apata (bon 23 December 1992), wey pipul sabi wel as Teni The Entertainer na Naijà singa an song writa.

Hau E Tek Stat Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Teni fo 23 December 1992 insaid Legos Stat. Na Niniola, wey dey sing sista. E go Apata Memorial High Skul, kon leta go American Intercontinental Univasiti to get im Degree fo business administration.

Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

2016-2019:fargin, Askamaya an Odas Rekordin

Teni du im first song Amen wen e dey onda Shizzi Magic Fingers rekods. Teni leta komot fo di rekod compini kon go du kontrat wit Dr Dolor Entertainment fo 2017. Pipul sabi Teni wel wen e sing fargin fo September 2017. Pipul kon sabi am fo di wod wen e du Askamaya,Case an Uyo Meyo. Askamaya dey nomba 15 fo MTV Base's year-end fo di Top 20 Naija song wey hot pas fo 2018.

Fo 20 February 2019, Teni nem dey fo You Tube Music as singa wey jus kom an wey pipul lik pas. Fo May 3 2019, Teni rilis vidio fo Sugar Mummy song. Na 14 June 2019, e rilis niu song wey bi Power Rangers.

2019-2020:Billionaire E.P An Quarantine Playlist

Teni rilis E.P Billionaire on 11 October 2019. Di E.P Billionaire get 6 trak an na onli Teni du am. Na Jaysynths Beatz an Pleez bi di produsa wey wok fo di E.P. Insaid April 2020, Teni wit DJ Neptune tok say dem wan rilis E.P, wey dey kol Quarantine. Di EP get 4 trak wey produsa lik Tempoe, P.Prime an Dëra wok on top am.

2021-Present:Wondaland an Little (Love I Love) Fo 2 February 2021 Teni rilis di nem an day wey im niu album go kom out. Na fo im Instagram e tok di nem fo di album wey bi Wondaland.

Di produsa sey folo am wok for di album na Pheelz, Damayo, Tempoe, P. Prime, Millamix, Krizbeatz, an Ozedikus. Di album dey fo difiren plaz lik Apple Music, Amazon Music, Spotify, Deezer an Goggle play.

Fo 2022 Teni rilis niu song wey bi Little (Love I Love), Na fo United Kingdom e tek du di vidio.

Som Oda Kontrat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fo March 2019, Teni du kontrat wit Tom Tom, wey Cadbury Naijà dey du. On October 6 2020, Pm Nius tok say Teni don du Kontrat wit Globacom Naijà.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]