Jump to content

Tems

From Wikipedia

Temilade Openiyi (bon 11 June 1995), wey pipo no wel wel as Tems, na Naija singa, song raita, shi dey sing self.na wen ha song rish top 40 song for bilbod hot 100 for 2021 na dat time pipul Kom Sabi am wel, shi du one song wey shi kolabo wit Drake Di song na fountain an wit WizKid self for Di song wey bi essence,dem kon do essence remix wit Justin Bieber wish mek am get grami awods kol.

How Im Tek Stat Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Legos for Naija den bon Tems, ha mama na Naija pesin an ha fada na oyibo an naija pesin.na from smal dem don Pak go United Kindom.ha mama an papa no dey togeda as dem fight wen shi dey for five years old.afta wetin hapun Tems an ha mama wit ha broda Kom bak to Naija for Ilupeju Legos afta smal time dem Pak go lekki leta dem go Aja wey dey legos.na Bowen kolege skul Tems go bifor shi go stodi ikonomiks for sout afrika,na for di skul ha muzik Tisha kon dey wash am sey shi Sabi sing an shi dey Len how to sing wit ha broda an shi get piano wey shi dey use.