Tekno

From Wikipedia

Augustine Miles Kelechi Okechukwu (dem bon am on 17 December 1990), wey plenti pipu sabi as Tekno, na popula Naijà singa an song raita an rekod produsa. Im song Enjoy na im dem uze finish one episode of di Emmy-winin TV series Ted Lasso Sseason Three, Episode Seven).

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kelechi na fom Ivo Lokal Govmet Aria, Ebonyi Stet, Nigeria. Dem bon am insaid Bauchi Stet insaid famili of six - five bois one girl. E gro for difren plez for di kontri lik; Nasarawa, Kaduna an Abuja bikos im papa na Nigerian Army. Wen e dey 8, Tekno Miles go muzik skul wia e tek sabi pley piano an guitar wel. Spotless, wey dey sing for Naija, na im broda.

Muzik wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tekno Miles fest sign onda K-Money Entertainment. Song wey dem fest uze sabi am wel wel na "Holiday", wey e rilis onda imprint, wey Davido sing insaid.

Insaid 2012, Julius Agwu, wey bi Nijà komedian ci am for one sho in Abuja, Afta pipu lik di song wey e sing wey bi "Onye me kwu", na remix of Ice Prince's "Oleku". Na di sem sho e tek ci Iyaya an Uni Franklin, di manager of Made Men Muzik Grup. Ubi Franklin an Iyanya tel Tekno mek e kom Legos for im muzik wok.

On 5 October 2013, e saign a rekodin kontrat wit Made Men Music Group (MMMG), onda wey e rilis song lik "Dance" an "Anything". Na dis muzik mek im nem dey "Best New Act of the Year" katigori for 2014 Nigeria Entertainment Awods. On 18 June 2015, Tekno Miles rilis one song wey pipu sabi wel wel, "Duro", wey DJ Coublon produs. Dem lik "Duro" for Afrika an insaid US. E du remix of di song, Duro, wit Phyno an Flavour N'abania wey e rilis on 16 November 2015. Di song rish top for plenti Naija an intanashonal charts, e rish nomba 5 on Capital XTRA's Afrobeats Chart.Capital XTRA's Afrobeats Chart: Top 10 for September 2015, On 20 November 2015, Tekno Miles rilis new singu wey bi "wash". Na DJ Coublon produs am an na AJE Filmworks diaret di video. On 27 December 2016, Tekno nem dey top 10 hip-hop an R&B to ci in di United States in 2017 Billboard. Dem stil sabi Tekno as Pana Masta an Big Tek.

In 2016, Elton John pley Tekno song wey bi 'Diana' insaid one episode of Rocket Hour redio sho on Apple Muzik.

On 13 October 2017, Tekno deydey folo DJ Cuppy sing Green Light song, wey bi DJ Cuppy fest song wey dey for poblik.

On 12 December 2017, Canadian rappa, Justin Bieber, post for Instagram pisho wia im an Tekno dey.

On 15 August 2019, dem anous Tekno as one of di produsa wey wok for Swae Lee song 'Won't be late' song wit Drake.

Insaid 2018, Tekno saign deel wit Universal Music Group Nigeria (UMGN). Na pat of Universal Music Group.wey dey for West Afrika, an di UK Island Rekods. Insaid July 2019, Tekno dey insaid Beyonce's The Lion King: The Gift saund Trak on di song Don't Jealous Me. On 6 December 2020, Tekno rilis di Traklifor im album, Old Romance. In 2022, e du Buga song wit "Kizzz Daniel".


Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Albums

.Old Romance(2020).

Singles


Year Track Album
2013 "Holiday" rowspan="37" Templet:N/A
"Onye Ne Kwu"(featuring Ice Prince)
2014 "Dance"
"Shoki"(featuring B-Red)
"Go Low"
"Mess"
"Zima"
"Jonzing"
"Anything"
2015 "Duro"
"Maria"
"Wash"
2016 "Where"
"Pana" "Rara"
"Diana"
2017 "Yawa"
"Be"
"Samantha"
"Go"
"Mama"(featuring Wizkid)
"Only One"
2018 "Your Luv"
"Jogodo"
"Choko"
"On You"
2019 "Woman"
"Uptempo"
"Skeletun"
"Surulere"
"Agege"(featuring Zlatan Ibile)
2020 "Beh Beh"(featuring Masterkraft)
"PuTTin"
"Enjoy"
2022 "Mufasa"
"JINJA" >
"Pay"


Rekods e produs[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Title Album
2014 "Show" (Victoria Kimani) rowspan="3" Templet:N/A
2015 "Feeling You" (Rima featuring Tekno)
"Pray For You" (Lynxxx featuring Tekno)
"Boss" (Ice Prince) Jos to the World
2016 "Last Station" (Stonebwoy featuring Tekno) Templet:N/A
2017 "If" (Davido) A Good Time
"Catch You" (Flavour) Ijele the Traveler
"Silika" (Madee featuring Tekno) rowspan="6" Templet:N/A
"Go" (Tekno)
"Green Light" (DJ Cuppy featuring Tekno)
2018 "Jogodo"
2019 "Agege" (Zlatan Ibile featuring Tekno)
"Won't Be Late" (Swae Lee featuring Drake)

"


Year Award ceremony Prize Recipient/Nominated work Result
2014 2014 Nigeria Entertainment Awards Best New Act of The Year Himself Nominated
2015 9th Nigeria Music Video Awards Best Pop Extra Video "Duro" Won
2016 2016 Nigeria Entertainment Awards Hottest Single Nominated
Bes Best Music Video of the Year Nominated
Afropop Artist of the Year Himself

}

2016 MTV Africa Music Awards 2016 Best New Act Himself Won WatsUp TV Africa Music Video Awards African Video of the Year

Best African Male Video
Best West African Video
Best Afro Pop Video

Pana Himself Nominated
2016 Soundcity MVP Awards Festival Song of the Year Himself {{
2017 BET Award 2017 Best International Act Africa Himself Nominated
Nigeria Entertainment Awards Best Single of the Year Himself Nominated

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

In May 2018, Tekno bon niu pikin,wey bi girl.

In 2020, Tekno anous sey e don dey dey an e no sabi Wen kom dey kom bak . Na Wen pipu wey dey Naija Nashonal Assembli dey trai chenj Naija nem to UAR, wey stan for United African Republic or United Alkebulan Republic on 2 June.

In 2017, Tekno anous sey e get acid reflux. E tok sey di disease don afet im voic. E go du surgery to tek komot am.