Sergio Ramos

From Wikipedia
Sergio Ramos
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromSpain Chenj-am
Country for sportSpain Chenj-am
Nem for lokal langwejSergio Ramos Chenj-am
Orijina nemSergio Ramos García Chenj-am
Fest nemSergio Chenj-am
Famili nemRamos Chenj-am
Second family name in Spanish name Chenj-am
Wen dem bon am30 March 1986 Chenj-am
Ples wey dem bon amCamas Chenj-am
Pesin wey e mariPilar Rubio Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokSpanish, Japanese, English langwej, French Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitycentre-back Chenj-am
Member of sports teamSevilla FC Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Sport number4 Chenj-am
Awod wey e koletGold Medal of the Royal Order of Sports Merit, Medal of Andalusia Chenj-am
Official websitehttps://www.sergioramos.com/ Chenj-am

Sergio Ramos García ( dem bon am on 30 March, 1986) na Spanish futbola wey dey pley for Ligi one klub Paris Saint-Germian. Dem sabi am wel on how e dey tek pley bol, e dey kolet bol fom playas leg wel wel. Plenti pipu tok sey na one of di bes playa bikos e don pley for beta big klubs, e pley for Madrid for sixteen sisin, e win four Champions League, two UEFA European Championships an di 2010 FIFA Wod Kop wit Spanish nashional team.

E fes stat to dey pley for Sevilla youth akedemi an e yuz two years for sinior tim, Ramos komot dia go Real Madrid in 2005. E pley wel wel for Real Madrid wey mek am win 22 honors wey La Liga an four UEFA Champions League dey insaid. Ramos dey insaid playa wey dey pley for bak wey don skore pas. Ramos skore insaid di 2014 UEFA champions League final, e skore for 2016 UEFA champions League final.

Ramos don win La Liga bes defender five times, an e dey insaid La Liga team of di season in 2015-16. In 2016 e join Paris Saint Germain on free transfer. E dey insaid UEFA team of di year nine times.

For im kontri, e don pley four Wod Kops an three European Championships. E win di 2010 FIFA Wod Kup an di UEFA European Championship in 2008 an 2012, im nem dey insaid 2010 FIFA Wod Drram Team in 2010 an di UEFA Euro Team of di Tournament in 2012, E fes pley for Spain wen e dey 18 years old an, in 2013, na im smol pas for insaid playas wey don rish 100 caps. Na Ramos bi di playa wey don get caps pas for Spain nashional team an na im bi di kontri ninth playa wey don skore pas. Na im win pas for Spain, e don win 131 match for dem. In February 2023, Ramos tok sey e no dey pley for im kontri again.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ramos get four pikin wit pesin wey dey tok nius Pilar Rubio, dia two don dey togeda sins September 2012. Ramos mari Pilar Rubio on 15 June 2019.

Dem dey kol am famili man bikos e dey lik to dey togeda wit im broda an im papa an mama. Rene, wey bi Ramo's broda na futbol agent. Ramos lik anoda sport wey bi to dey uze bull faight.

In June 2014, Na Ramos bi di ambassador for UNICEF Spain.

Tins wey dey for im bodi

Ramos dro som tins for im bodi, hol di tins pas 42, e dro Jesus an Mary, Star of David bikos of im granmama wey kpai, Nana, lion, wolf, map of Spain, American chief, hamsa, FIFA Wod Kup an Champions League Kup, im famili dey insaid wetin e dro tu.

Hau e tek wok for teble[chenj-am | chenj-am for orijin]

Klub

As of match wey e pley on 3 June 2023

Wia dem gadadi tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Wright Chris (20 August 2019) "Toke Poe Daily: Sergio Ramos' tattoo: suffered rabbit, a football pitch, tribute to Bansky". ESPN