Sarkodie

From Wikipedia
Sarkodie
pesin
Subclass ofaudio track Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromGana Chenj-am
Orijina nemMichael Owusu Addo Chenj-am
Fest nemMichael, Micheal Chenj-am
Famili nemOwusu, Addo Chenj-am
AliasSarkodie Chenj-am
Wen dem bon am10 July 1988 Chenj-am
Ples wey dem bon amKoforidua, Tema Chenj-am
Fest langwejAkan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Twi Chenj-am
Wok wey e dey dumusician, rapper Chenj-am
Wie e dey livTema Chenj-am
Wen e stat wok2005 Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
DiscographySarkodie discography Chenj-am
Stai of song abi fimhip hop music, hiplife, Afrobeats Chenj-am
Official websitehttp://sarkodielive.com Chenj-am

Micheal Owusu Addo (dem bon am on July 10, 1988)[1]dem sabi am for im wok as Sarkodie na Ghanian singa (rappa), songraita, an e dey du biznes wey kom fom Tema. Di kain wey e dey sing song don mek pipu sabi am wel wel. E don win plenti awod lik; Vodafone Ghana Music Awod for Artist of di Decade, fes winna of BET internashonal flo artist at di 2019 BET Hip Hop Awod. E dey insaid pipu wey mek dem sabi Azonto dans.

Im life an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hau e tek stat life an wok

Sakordie na nomba four pikin insaid five pikin an dem bon am on July 10, 1988. E gro up for Koforidua bifor im papa an mama kon kari dem go Tema, na Tema e tek go skul. E go Tema Methodist Day Senior High School an stil go IPMC, wia e for tek get digree for graphic design. Sakordie fes stat to dey go smol smol kompetishon lik Adom FM rap kompetishon kasahare level. Na for dia e ci im bifor bifor manaja Duncan Williams of Duncwills Entertainment.

Hau e tek dey hep pipu[chenj-am | chenj-am for orijin]

On July 13, 2013, Sarkodie stat di Sakordie Foundation, wey e du to dey hep smol smol pikin wey dia papa an mama no tu get moni. E don go hep dem for Royal Seed Home Orphanage in Kasoa. On December 25, 2014, im foundation stat feed di kids campaign for Tema, Ghana, dem giv plenti smol pikin bags of rice an youghurt.

Im biznes an kompini e du kontrat wit[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Sarkodie get di Sark by Yaks kompini wey dey du cloth, e stat am on April 27, 2013.[2]. In 2012, Samsung Electronics sho pipu sey Sakordie na dia niu ambassador for Universiti of Ghana, Legion. Sakordie na ambassador for Fanmilk Ghana in 2013. Sarkodie du deel wit Tigo Telecommunications Ghana, wey sponsor im 2013 Rapperholic tour. Sakordie get endorsement deel wit Standard Chartered Bank. Im bi di ambassador for Guiness Ghana Limited for dia Malt drink. On 30 October 2019, na im bi di ambassador of di year for di year return campaign; dem giv am di awodnat Creative Arts Industry Forum. In 2021, Sarkodie an im pikin dey insaid Pepsodant Ghana's #BrushWithMe campaign. Dem du am to tek tel pipu to dey brush day an naight.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sarkodie Mari Tracy insaid smol weedin wey e do for Tema, Ghana on 17 July 2018. Na two pikin e bon.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Studio album Makye (2009).

Rapperholic (2012)

Sakorlogy (2014)

Black love album (2019)

No pressure (2021)

Jamz (2022)

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]