Jump to content

Sarah Rivens

From Wikipedia
Sarah Rivens
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromAljiria Chenj-am
Fest nemSarah Chenj-am
Famili nemRivens Chenj-am
Wen dem bon am19 December 1999 Chenj-am
Ples wey dem bon amAlgiers Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokFrench Chenj-am
Wok wey e dey duraita Chenj-am
Pat of wok wey e put mindliterary activity Chenj-am
Awod wey e koletQ140460580 Chenj-am

Sarah Rivens (dey bon am 19 December 1998) na Algeria wuman wey dey rait buk. As eli as 2023, na Rivens buk sel pass for France as e dey rait one long buk wey e nem na "Captive". As na 9 million pipul don rid Rivens buk, dis one mek Rivens di Algeria raita wey pipul rid im buk pass for histri.

Hau im tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2019, Rivens poblish im raitin for "Wattpad" an pipul kom sabi to dey no am for sosha midiha.

Na "Captive series" wey Rivens rait mek am popula wel wel. Na "Wattpad" Rivens fest yuz rilis "Captive series" an e yuz one fake nem "theblurredgirl" as di nem of di pesin wey rait am dorin lait 2020 an eli 2021 wen COVID 19 disis stil de. "Captive series popula wel wel for Tik Tok an e get one logo wey bi #captivewattpad. Na 9 million taim pipul luk am for Tik Tok. Na Hlab poblishin kompini Rivens de. Dey don rait "Captive series" into difren 9 langwej an e go don rish 300,000 buk of "Captive Series" wey dey don sel an na 50,000 soft kopi of di buk na im pipul get. As at April 2023, na 5,000 kopi of "Captive Series" dem dey sel evri wik.

Buk-dem wey e don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Captive - tome 2 Bonus. Hachette Lab. 9 December 2022.