COVID-19 Pandemic

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

COVID-19 Pandemic wey pipul sabi as di coronavirus pandemik na one disis wey dey hapun for di hol wold wey one vairus kol SARS-CoV-2 dey korse.Na for Wuhan for China dey fest sabi dis vairus.Di December 2019, Pupil du dia best mek di korona vairus no komot fom China so far di disis no go kach oda pipul for di wold but dis tin no wok.Di "World Health Organization (WHO)" tok sey di disis don bi konsain for di wold for January 30, 2020.WHO tok for March 11, 2020 sey di disis don almost rish di hol wold.By November 24 2022, Korona vairus don kos problem wey rish 639 millions an 6.62 million don kpai bikos of di vairus. Dis one mek Kovid-19 one of di badest sickness in histrie. Di sahin wey go sho sey pesin don get Koro( Korona vairus) bi fifa, koff an pesin fit dey Taya. Pesin fit even get koro an e no go no ontime bikos e fit no sho one sahin of di siknes.Di siknes dey kwik kwik sho for pipul wey don old an pipul wey don get som siknes for bodi bifor Koro kom enta di bodi.

Kasis of Korona vairus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ofishia kasis wey di ples wan tok abaut na di nomba of pipul wey dey don test sey dey get di koro vairus.Bikos of di ojoro or wayo wey den happun if dey wan kaunt pipul wey get di siknes, di nomba of pipul wey get am plenti pass di nomba wey dey kaunt. Meni kontrie wen dey fest atata to kaunt pipul wey get koro no fest dey kaunt pipul dey di sahin neva too sho for dia bodi.Di pipul wey too fat, wey get dihabetis, wey dey hat too dey kut na im dose kontrie fest dey test for koro bikos na dem dey sho sahin of koro fast. For di year 2020, di ripot for China sho sey pipul wey dey bilow 20 years no too dey kach korona.Dis one fit min sey onda twenty pipul no do dey kach di siknes or dey sahin OF di sikness no too dey sho for dia bodi. Anoda stodis for China stil sho sey na lai, sey korona vairus no dey luk faze sey na bot pikin an big pipul di siknes dey kach.

Pipul wey don kpai bikos of Korona vairus[chenj-am | chenj-am for orijin]

As of December 2020, Pipul wey don kpai bikos of koro don pass 6.64 million. Di fest pesin wey kpai bikos of koro hapun for Wuhan wey dey China for January 9, 2020. By di time wey May 2022 go rish, WHO tok sey pipul wey koro don kpai pass 14.9 million. Di time wey di koro enta bodi an di time wey pesin fit kpai na bitwin 6 days to 41 days. Di time wey meni pipul dey kpai pass na 14 days afta koro don enta bodi.

Sahin sey pesin get Korona vairus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sahin plenti wey dey sho sey pesin don get Koro. Som sahin no too get pawa like dat but odas strong wel wel. Some sahin na Hedik, pesin fit no dey smell tins wel, kata dey komot for nose, bori dey pain pesin, turot go dey dry, fifa, pesin go dey shit wota wota shit enihow an pesin go find am had to Briet well.Two pesin fit get Koro an na difren sahin dey go dey sho.

How pesin fit get Korona vairus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pesin fit get am wen pesin wey get di koro for bodi briet, tok , sneeze an dia split enta anoda pesin wey no get am mouth.

How pesin fit no get di Korona vairus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pesin fit go get injection wey Oyinbo dey kol "Vaccination ", mek pesin no komot for house, mek pesin dey wash hand wit soap an wota, mek pesin no go nia pipul,