Ruth Tongue

From Wikipedia
Ruth Tongue
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Wen dem bon am1898 Chenj-am
Wen e kpai1981 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufolklorist, storyteller, poet Chenj-am
Pat of wok wey e put mindpoetry, oral literature, collecting Chenj-am

Ruth Lyndall Tongue (dem bon for February 1898 an shi kpai for September 1981) na oyinbo pesin wey dey rait an tok tori wel wel an shi don du plenti lokal an som oda buks.

Tori abaut im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ruth Tongue for Handsworth, Shi bi di third pikin an na shi smol Pas insaid Edwin Tongue wey bi im papa, wey bi kongrigashon minista an im waif Mabel Jones. Di famili pak go Tauton wen Ruth's stil dey smol, an dem kon stil pak komot for dia go Middle sex for 1908. Bikos sey Ruth don gro, shi stat to dey go klas for London kolej of muzik an leta go stodi for London Siti Literal Institute. Shi kon wok as a tisha an shi stil laik muzik an drama. For 1950 shi pak go Crowcombe, Somerset na for die Shi stat to dey paform to dey tok tori an tok on tradishonal Mata bot di two na for lokal pipu an for insaid redio shi for dey du am. Shi add tori to di koleshon of tradishonal mata Katherine Briggs, na shi hep ha du ha own manuscripts for poblikashon, an shi kon leta join bodi wit am mek dem du one buk wey im nem na Folktales of England.

Tongue kom gom pipu wey go skul wel wel, shi feel about di repot wit di kontri folk of Somerset. Shi tok sey im mama bon am durin chime hour on Friday night, na dis one kom mek am get diffren koneshon wit di pipu of kontri-side; rekod tok sey na Monday dem bon am. Shi don tok tori of di Asra, sea morgan, lazy Lawrence, hyter sprites, oekmen, an plenti plenti oda kreshors, wey don appear for Briggs encyclopaedia of fairies an in leta koleshon of folklore or fantasi.