Remi Abiola

From Wikipedia

Remi Abiola (August 1953 - 28 July 2009) shi bi Naija fim aktress and wife of di Late Moshood Abiola , wey bi Naija business man and politician. Shi die of cancer for New York City for 28 July 2009. Shi bon two pikin wey their nem na : Abimbola Umardeen and Olajumoke Adetoun.

How shi tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem train Remi as aktress for di Fielding School for Dramatic Arts for England in di 1970s afta shi komot for di defunct Nigerian Airways as a flight attendant. Wen shi kom back Naija, shi du audition for rol and shi pla som part inside one TV series wey Bayo Awala and Tunde Oloyede dey organize for NTA Channel 10.