Phyna

From Wikipedia
Phyna
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Ples wey dem bon amEdo State Chenj-am
Wok wey e dey duactor, hype man Chenj-am
E pipulNigerians Chenj-am
Participant inBig Brother Naija, season 7 Chenj-am
Hashtagphyna𓃰 Chenj-am

Ijeoma Josephina Otabor (dey bon am 2 June 1997) wey bi now wel wel as Phyna na Naija aktress, model, bak-up singa for muzikshan, entatenar, an rihaliti TV star. Na Phyna win di Big Broda Naija Sisin 7.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Legos Stet dey tek bon Phyna but e kom from Esan tribe in Edo Stet. Na for Edo Stet e tek do e pamari an sekondiri edukeshon. Phyna go rid Enjinerin from Auchi Politeknik.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor Phyna enta Big Broda Naija house, Phyna dey do fashon model dey kolet moni. E start dis fashon wen e stil de kolej. Phyna bi di nomba 10 pesin wey enta di 7th Sisin of Big Broda Naija (Level Up) on 23 July 2022.

Wen dey wan pik chuz pesin wey win for di sho for 2 October 2022, na Phyna kari fest with 40.74% (pacent). Bryann kari sekod with 26.7% (pacent). Phyna kolet di #100,000,000 prize for di sho. Phyna bi di sekod gel wey wan kari fest foe di 'Big Broda Naija show afta wey Mercy Eke kari fest three years bifor.

Kompini wey e dey helep sell dia prodot[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Rixariskskinscrets
  • Speedy weightloss