Mercy Eke

From Wikipedia

Mercy Eke na Naija aktress, an e dey dans for muzik vidio. Na from Imo Stet e kom from an na Eke win di sisin 4 Big Broda Naija in October 2019. Eke bi di fest wuman wey wan win Big Broda Naija sins di rihaliti show start. Na Eke bi di fonda of "MNM luxury". On 14 March 2020, Eke win di fimale wey sabi dress pass for Africa Viewer's Choice Award.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Imo Stet wey de Naija dey bon Mercy Eke. E go Egbu Girls Sekondri Skul in Owerri an leta finish Imo Stet Yunivasiti in 2014. Eke dans inside di muzik vidio wey Davido an Ichaba do wey di tahitu bi "Baby Mama". Eke stil dans inside Airboy muzik vidio "Nawo Nawo". Na four times Eke beg "Big Broda Naija" bifor dey chuz am to enta di kompetishon.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na on 30 June 2019 Eke enta di house for "Big Broda Naija". Dem chuz am as di winna in October 2019. Dis one mek am di fest wuman to win di kompetishon.

Afta wey Eke don win "Big Broda Naija", e start to dey ambasedor for meni kompini. Inside 2020, Eke start to dey akt Nollywood fims an na Fate of Alakada bi e fest fim wey e de inside. Eke dey akt inside som smol smol komedi fim-dem wey som komedian dey do. For July 2023, e nem enta di list of pipo wey go enta di house for "Big Broda Naija All Star"