Philip Shaibu

From Wikipedia
Philip Shaibu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemPhilip Chenj-am
Famili nemShaibu Chenj-am
Wen dem bon am1 December 1969 Chenj-am
Ples wey dem bon amKaduna Chenj-am
Fest langwejYekhee Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Yekhee Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the House of Representatives of Nigeria, Deputy Governor of Edo State Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Jos, University of Benin Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am

Philip Shaibu (dem bon am on 1 December 1969, for Kaduna) na forma Univasiti of Jos skul pesin, na Naija politishan. Na im bi di Deputy govnor of Edo State, Nigeria.

Im pasonal life an edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen e smol

Dem bon Shaibu for Kaduna insaid Kristian famili. Im papa na Pasto Francis Osikpomobo Shaibu (e don kpai), an im mama na Lucy Momoh.

Hau e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di fest skul wey e go wen e smol na St Augustine Primari Skul, Tundu Wada Kaduna, e kon finish for L.E.A Primari Skul Barnawa, Kaduna State wia e fest get skul certifikate, Shaibu get im West African Senior School Certificate in 1986 afta e go Saudana Memorial Sekondri Skul, Kawo Kaduna. Comrade Shaibu get Bachelor of Science digre (Honors) in Accounting fom di Universiti of Jos in 2000, wia e bi president of di National Association of Nigeria Student (NANS) for 2000 an 2001 an a masta of Biznes Administration (MBA) fom Universiti of Benin in 2015.

Im famili life[chenj-am | chenj-am for orijin]

E mari mrs. Maryann Phillip-Shaibu an dem don bon pinkin.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Philip Shaibu fest stat to dey wok as e komot for skul wit Nigeria Prisons Service, Abuja. E leta komot wen e rish Assistant inspector of prisons post in 2002 to get taim du politis wel wel.

Politis wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Philip Shaibu fes stat to dey du politis in 2003 Wen e wan go for Edo State Haus of Assembli onda All Nigeria people's Parti (ANPP) e no enta.

Shaibu trai enta in 2007 as pesin wey go stand for Estako West Consistency onda Action Congress (AC) for Edo stet Haus of Assembli, na im enta. For di Haus of Assembli na im bi di majority leader on 24 February 2010 afta dem komot Rt Hon. Zakawanun Garba as spika of Edo Stet Haus of Assembli.

In 2015, afta e don uze eight years for Edo Stet Haus of Assembli, e kon go trai go stand for Estako pipu for insaid fediral Haus of Representatives. Na im win wit 42,079 votes an pesin wey folo am na Abass Braimah wey get 29,941 votes.

Na onli im dey as pesin wey go bi Deputy govnor for govnor Goodwin Obaseki for di las eleshon wey dem du for 2016 Edo State gubernatorial eleshon an na dem enta.

On 16 June 2020, Shaibu komot for All Progressive Congress (APC).

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]