Oshodi Bus Terminal

From Wikipedia

Oshodi Transport Interchange na him dem build for inside Oshodi area of Lagos State, Nigeria. Di terminal tanda gidigba between di Lagos-Apapa expressway and the Agege motor road. Dem divide the Terminal into three different terminals wey dem call: Terminal 1, Terminal 2, and Terminal 3.[1]

How dem build am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na di Construction firm wey dem dey call Planet Projects Limited build the Oshodi Bus Terminal for total money wey dem estimate to be around $70 million. Dem build di bus terminal make e fit accommodate about 820 mass transit buses.

Terminals and facilities wey dey inside[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Oshodi bus terminal na him dem been divide into three terminals wey be: Terminal 1, Terminal 2, and Terminal 3. Each one of di bus terminals get 30000 square meters of land and get plenty better facilities like: loading bays, ticketing stands, driver lounge, parking areas, restrooms etceteram etceteram. Di Oshodi Bus Terminal begin work for May 2019 as di contractor wey dey hadle di project been announce. Terminal 1 na for intercity travels and dem design am for journeys wey cover di southwest, southeast, FCT, and Northern states. Na Terminal two dey for intercity waka wey cover routes like. Ikeja, Agege, Iyana Ipaja, egbeda, Abule Egba etc. Terminal 3 na him cover route such as Mile 2/Festac, Airport road, Bariga/New Garage, Tincan, Orile, Apapa/Wharf, ejigbo, Ajegunle/Boundary, Ojodu/Berger, Gbagada/Anthony, Eko Ijumota, Iyana Isolo/Jakande Gate/ Itire, Ojota/Ketu/Mile 12, Adeniji, Eko Hotel.

How dem take open am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Oshodi Bus Terminal was Opened by our Presido Muhammadu Buhari on 24 April 2019,other people wey been dey the opening na before before Lagos state Governor, Akinwunmi Ambode, Present Governor, Babajide Sanwoolu, Abiola Ajimobi, Ibikunle Amosun and plenty plenty other ogbonge we naija people.

How we take gather the tori[chenj-am | chenj-am for orijin]