Omotayo Akinremi

From Wikipedia

Omotayo Akinremi(dem bon am for 13 September 1974) shi bi Naijá runna wey don ritaya. Shi don trai to win cup inside Naijá and Obodoyibo and shi trai fait for Naijá to win cup wel wel. Shi win gold medal for di 1992 an 1993 African Championships in Athletics for di 400 metre hurdles. Shi stil win bronze medal for di 1990 an for di 1991 All-African Games shi stil win bronze medal for di 400 metre hurdle. Shi stil win di 200 metre for di 2000 Oceania Athletics Championships. Shi even dey for di tim for di Naija 4 x 400 m relay wey win bronze medals for di 1993 Summer Universiade wit Olabisi Afolabi, Omolade Akinremi an Onyinye Chkezie.