Olumo Rock

From Wikipedia
Olumo Rock
rock, tourist attraction, fountain
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityAbeokuta, Ogun State Chenj-am
Coordinate location7°10′2″N 3°20′33″E Chenj-am
Map

Olumo Rock na montain wey dey inside di south western pat of Naijá in di Citi of Abeokuta wey dey Ogun stet.Di vilej pipu dey hid inside Olumo Rock wen fight-fight hapun bitween oda tribe-dem for potenshion in di 19th Senturi. To sho how important dis rock be, di Yoruba pipu from Abeokuta see dis OLUMO as their Orisha(god). "Olu" mean god wey "Mo" kom mean mold ( mek pesin dey mold somtin).

Where E Dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abeokuta bi di lokashion an from legos to Abeokuta na just one hour pesin go use forbroad and naso Legos sef be like home to di airport wey near Abeokuta wey bi di Murtala Muhammed International Airport. Hotels dem wey dey around di rock bi Gateway hotel plus Olumo Guest House.

For earli 2006, som kain repair wok wey sho for dat aria kom bring life enta di site. Tins like new musihum, ples wey pipul fit chop, waterfalls plus even sef di old Itoku maket wey market pipu plus pipu wey dey do handwork kom mek koret bizines for there. Tins kon stat begin swit weluwelu as kustomars and sella go just dey drag to mek sure sey dem get di best prise to sel an buy so dat nobodi go luze.

Even sef dis veri maket dey outside di Olumo Rock kompound. Dis sem veri spot gongon bi where di Abeokuta indostri of tie-an-dye wey plenti pipu sabi as Adire tek stat. Dis Adire maket wey bi say na wuman dem plenti ( bot old & young) inside di bizines, dem dey du different different design , sho-kase am for their shop wey dey along di road so dat kustomars go see-am buy.

For di bak of di shop wey these wuman dem dey do their bizines bi house where dem do stay , wey stil serve as their factory where dem dey die their matirihas, naso their papa & mama wey bon dem sef tek run tins bifor dem kaput.

Pipu wey dey stey klose to dis Olumo Rock sabi Welkom visitors veri wel anitime dem sho, ansa their kweshons welwel even sey no bi their work to do so but their own Tori dey swit pass di pesin wey sopoz tek dem waka. Oda popula tins wey pesin fit see buy for there bi lokal beads wey belelekie, bracelets, sculptures plus musical instruments like di sekere an toking drum.

Trip Inside Olumo Rock[chenj-am | chenj-am for orijin]

As you dey enta inside di rock, e get dis man-made stairkase wey dem kut wey go hep you waka inside an as you dey klimb naso your leg go just dey jam smol smol rock webi different different size of stones na you go dey match as steps (somtaims sef ladda fit dey to hep you waka inside di rock) through one small tight korrido wey go mek you Waka go di top of di rock. As you even dey klimp go up, your eyes go dey see different different tins wey dem carve put for di bodi of di rock like kowries statue plus di olden daizs hause of the priestesses for di montain wey bi stey for hut dat taim.

Tourism[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dis very montain na one popular ples wet dey obodo Naijá an even visitos all ova the world dey kom visit dis wondaful rock. And na for di centa of Abeokuta wey mean "Under the rock" you fit find am. E get hight of 137 mitas wey far from sea level. An e go shok you to know say na di egbas bi the fest set of pipul to dey stey around the rockside bikos dem see there as ples wey dey veri safe plus say from dat side, dem fit to monitor their enimes. But as d town of Abeokuta kom dey grow, na so new settlers begin waka comot from the location.