Olive Walke

From Wikipedia
Olive Walke
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromTrinidad and Tobago Chenj-am
Orijina nemBeatrice Olive Walke Chenj-am
Fest nemOlive Chenj-am
Wen dem bon am21 December 1911 Chenj-am
Ples wey dem bon amBelmont Chenj-am
Wen e kpai10 September 1969 Chenj-am
Place of deathPort of Spain Chenj-am
Fest langwejEnglish langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusic teacher, ethnomusicologist, politician, choir director Chenj-am
Pat of wok wey e put mindmusic of Trinidad and Tobago Chenj-am
Post wey e deyMember of the Senate of Trinidad and Tobago Chenj-am
Wie e go skul11 and 13, Mandeville Place, Royal Academy of Music Chenj-am
Wen e stat wok1940 Chenj-am

Olive Walke MBE (dem bon am for 21 December 1911 an e kpai 10 September 1969) na Trinidadian muzishian an di fest pesin to gada "Caribbean tradishonal song togeda.Na e fom an daret di popula muzik grup "LA Petite Musicale".Walke daret di grup for meni years.Walke bi sinator in di fest Palimet of Trinidad an Tobago wen di kontri get e indipedet.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na on December 21, 1911 dey bon Beatrice Olive Walke in Belmont aria wey de Pot of Spain, Trinidad. E mama nem na Anella an e papa nem na Samuel Arthur Walke.Na Walke anti wey bi Edith an e onkul wey bi Simeon Hayes train am. Walke go "Tranquility Girls School" an di "Intermediate Government School" bifor e kom finish from Bishop Anstey High School. Walke kom waka go London go kontiniu e muzik edukeshon as ego rid muzik in Triniti kolej of Muzik. In 1936 wen e stil de London, Walke mit e hosband Frank Hercules wey bi studet of "Trinidadian Student of Law". E hosband leta bikom pesin wey pipul sabi as raita. Afta wey Walke finish wit ATCL digri, e leta forda e edukeshon for muzik at di Royal Akademi of Muzik.Walke bon one boi for Frank Hercules an dey nem am John. Wen e don kolet e satifiket from di yunivasiti, e go bak to Trinidad.E hosband Frank sef komot from London go New York. Na dis tin mek di marej skata. Di pikin wey dey bon kom dey stey wit Walke anti Edit an Walke onkul Simeon Hayes.John Simon Anthony Hayes kom leta bi fest kidni doktor to kom from Trinidad an Tobago an na Walke pikin form di "Trinidad and Tobago Kidney Foundation"

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Walke fest stat to dey giv muzik lesin an e dey tok for one redio show wey dem dey du evri wik kol "Musicians in the Making".Di show na to hep up komin muzishian to dey popula so dat pipul go no dem. For December 1939, Walke fom one muzik grup wit di nem "La Petite Musicale". Di grup dey sing tradishonal Krismas song.Na for Walke house di grup dey pratis. Afta pratis, di grup go rent motor go pipul house dey sing in dia komuniti. Afta di niu year, di grup stat to dey sing tradishonal muzik of Trinidad and Tobago.