Nnamdi Okwu Kanu
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Wen dem bon am | 25 September 1967 |
| Ples wey dem bon am | Abia State |
| Wok wey e dey du | political activist |
| Wie e go skul | University of Nigeria, Government College Umuahia |
Nnamdi Okwu Kanu ( dem bon am on 25 September 1967) na British- Naija politika hativist pesin wey dey fight mek Biafra Riplobik hapun for Naija. Biafra Riplobik Na di hadiya sey mek Igbo pipo brek komot from Naija an get dia govamet wey go difren from Naija govamet. Na Kanu bi di oga kpata kpata of Indigenous People of Biafra (IPOB), wey e stat in 2014. Wetin mek dem stat IPOB na to trai mek stet wey dey for Easta pat of Naija dey on dia own. Na di sem tinkin hapun wey mek Naija Civil War hapun for 1967 - 1970.
Na Kanu bi daretor of United Kingdom Redio steshon wey dem dey kol Redio Biafra. Dem hares am for Legos, Naija on 14 October 2015 an e dey wit pipu wey govamet don hares for ova one year. Wen e dey go kourt e lik to dey wia Jewish praya shawl an somtin wey dey kova im head. E tok for kourt sey e bilif in rilijoin kol Judaism, an sey e see imsef as Jew pesin. E don dey front dey kari Biafran pipu go difren praya wey Jewish pipu dey du. On 28 April 2017, dem rilis Nnamdi Kanu from prisin onda bail. Di polis an oda govamet pipu trai fit kontro IPOB pawa smol. As di fight dey kontiniu, Kanu tok sey IPOB no like wahala wetin d want na mek wahala no dey. In June 2021, Interpol hares Kanu for Kenya kon give Naija Govamet.
Hau e tek stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Kanu on 25 September 1967 insaid Isiama Afara Ukwu, Umuahia - wey dey insaid di land wey Repoblik of Biafran dey klaim. Im papa Eze Isreal Okwu Kanu (JP), an im mama, Ugoeze Nnenne Kanu, wey bi Naija Kings. E go Library Avenue Primari Skul an stil go Government College Umuahia for im sekondri skul edukashon. E stodi for Universiti of Nigeria, Nsukka bifor e go UK wen e neva finish.
Hau e stat d faight
[chenj-am | chenj-am for orijin]Kanu stat im faight to free Biafra as Radio Biafra redio an e dey insaid pipu wey dey wok onda Ralph Uwazuruike, wey bi oga kpatakpata of Movement for Actualisation of Sovereign State of Biafra (MASSOB), wey tok am for meeting wey dem du for Kaduna, Nigeria, on June 12, 2014, sey e don kari Radio Biafra give Nnamdi Kanu. Dem du Redio Biafra in 1967 to dey hep dem tok abaut hau dem go stat Biafra. Insaid 2014, e stat IPOB. On 5 September 2015, dem kol Nnamdi Kanu as tok tok pesin for World Igbo Congress wey dem du for Los Angeles, wia e tek tok sey dem want gun an bullet.
Katakata wey hapun
[chenj-am | chenj-am for orijin]Kanu don tok som tins wey don korse katakata sins e don bi oga for IPOB.
. In September 2015, insaid one tok tok wey e go e tok sey IPOB want gun an bullets.
. Insaid 2015, afta Deeper Christian Life Ministry oga kpatakpata William Kumuyi tok sey Nigeria go dey togeda, Kanu tok sey mek pipu gada stone am an du am enihau for Aba wia e wan du crusade.
. Insaid 2017, one video wey e du kom out, wia e dey tel forma Naija President Olusegun Obasanjo, sey e go kil am an hol im famili. E tel som pipu wey gada for im hauz sey if enitin hapun to am, mek memba of IPOB go kil I'm famili.
. Kanu tok sey mek Naija pipu redi for war, an im pipu don redi an dey plan hau di tin go hapun.
. Kanu tok sey if enibodi ask abaut Radio Biafra, wey bi Hausa, Yoruba or Fulani mek dem kil am.
. Kanu tok sey Niger Delta pipu no dey ear wod; sey dem no wetin dem go du for dem. Akwa Ibom, Bayelsa, Delta, Rivers, Edo an Cross Rivers Stet na Biafra na Biafra get am, an enibodi wey wan stop dem go kpai.
.Kanu tok sey eni army dem send to Biafra land go kpai for dia.