Niyola
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Nem for lokal langwej | Eniola Akinbo |
| Orijina nem | Eniola Akinbo |
| Fest nem | Eniola |
| Famili nem | Akínbò |
| Alias | Niyola |
| Wen dem bon am | 9 December 1985 |
| Ples wey dem bon am | Lagos |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | singa, artist |
| Wen e stat wok | 2005 |
| Hair kolor | black hair |
| Eye kolor | brown |
| Instrument | voice |
| Stai of song abi fim | soul, jazz |
| Record label | Empire Mates Entertainment |
| Personal pronoun | L484 |
Eniola Akinbo (dey bon am 9 December 1985) wey pipul no wel wel as Niyola na Naija singa an song raita.
How e tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Legos, Naija dey bin Niyola on 9 December 1985. Niyola bi di lass for di 10 pikin-dem wey e papa bon. Wen e dey smol, Niyola dey sing for chorch with e brodas and sista-dem. Na di sho of Funmi Adams wey e go mek am like to be a muzikshan. Wen Amen Starlet Kompetishon pik dia winna for year 2000, na Niyola dey pik as winna.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Niyola start to dey sing wel wel in 2005. Dat time, na eLDee's Trybe Rekod e de. Afta e komot for eLDee Trybe Rekod, e sahin with "Make Sum Noise Entatemet". Niyola fest 3 song kon out for dat rekod lebel. For 2012, Empire Mates Entatemet sahin Niyola. Na for 22 May 2013 Niyola rilis e fest song "Toh Bad" onda Empire Mates Entatemet.
Habom wey e don do
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Niyola (2008)
Fim wey e de inside
[chenj-am | chenj-am for orijin]Awod an Nominashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]| Year | Awod serimoni | how di awod bi | Risot |
|---|---|---|---|
| 2013 | The Headies | Best Vocal Performance (Female) | Nominated |
| Nigeria Entertainment Awod | Most Promising Female Act to Watch | Nominated | |
| 2014 | Nigeria Entertainment Awod | Female Artist of the Year | Won |