Nathaniel Bassey

From Wikipedia
Nathaniel Bassey
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am1978 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Wok wey e dey dutrumpeter Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Instrumenttrumpet Chenj-am
Country of originNaija Chenj-am

Nathaniel Bassey (dem bon am on August 27, 1981) na Naija singa, pasto, an e sabi pley trumphet an gospel songraita. Plenti pipu sabi am wit di song wey e rait "Imela", "Onise Iyanu", "Jesu iye" an Olowogbogboro. Afta plenti years wey e don dey sing, Bassey don mek imsef one of di pesin wey dem sabi for gospel songs an singa wey dey sing abaut God wey dem ear pas for Naija. E sabi sing difren kain sty of muzik lik worship, hymns an medley. E dey go di Redeemed Church of God an na pastor for di Oasis Lagos, di youth chorch of di RCCG Kings Court wey dey Victoria Island, Lagos.

Hau e tek stat life an edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Bassey for Lagos, Nigeria, on August 27, 1981. E kom fom Ikot Ofon Ikono, Uyo Lokal govmet aria wey dey Akwa Ibom Stet, south south Nigeria. Mr .E. Joshua Bassey, im papa, na Minista insaid di Apostolic Chorch Bashua Assembli. E stodi intanashonal relation an politis at di Universiti of Lagos bifor e go London to go stodi politis afta. E stil stodi muzik for Middlesex Universiti Summer Skul.

Muzik wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nathaniel stat im musikal wok insaid chorch, wia e join Rhodes Orchestra an pley trumphet for two years. Na im pley trumphet an sing song wen e go ci for Stella Obasanjo, waif of Olusegun Obasanjo bifor bifor Naija President. Insaid 2018, Bassey na one of di pesin wey dey holways pafom for di Experience. Im fest album wey d uze sabi am, Elohim, wey dem rekod an mix for South Afrika, insaid year 2008. Dem don tok abaut am as pesin wey dey tek God tins sirious wit di track, Someone's knocking at the door".

Nathaniel stat di #HalleluyahChallenge, insaid June 2017, wia Bassey an oda pipu worship God for one hour, fom 12:00am rish 1:00am. E put di chalenj for im Instagram pej an stil tel oda pipu to join am. Emo rish one month, do event don get 60,000 pipu wey don ci am. Di #HalleluyahChallenge for 2020 hapun fom February 4 rish 24 2020. Insaid 2021, Di chalenj hapun for 1st to 21 February.

Studio album[chenj-am | chenj-am for orijin]

Someone's at the Door (2010)

The Son of God (& Imela) (2014)

This God is too Good (2016)

Revival Flames (2017)

Jesus: The Resurrection & the Life (2018)

The King is Coming (2019)

Hallelujah Again (Revelation 19:3) (2021)

Names of God (2022)

Hallelujah Live (2023)

Jesus Iye (2023)

Yahweh Sobaoth (2023)

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Nathaniel Bassey: A blessing in our time. The Nation Newspaper, October 3, 2018.

2. " Criticism made Hallelujah Challenge Bigger - Nathaniel Bassey". Punch Nigeria. 23 June 2017.