Jump to content

Monday Okphebholo

From Wikipedia
Monday Okpebholo
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1970 Chenj-am
Fest langwejEsan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Esan Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the Senate of Nigeria Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am

Monday Okphebhol (dem bon am on 29 August 1970), na Naija biznesman an politishan wey don sarf as di senator wey dey stan for Edo Central senatorial district sins 2023. Na im bi di Govnor wey dem elect for Edo Stet.

How e tek stat life an edukeshon

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Okphebholo on 29 August 1970 in Udomi- Kommunity of Irrua. Okphebholo go Udomi Kommuniti Primari Skul an Ujabhole Kommuniti Sekondri Skul, dia two dey Uwesan Irrua, Esan Centra LGA. E finish im sekondri edukeshon an get sinior skul Certifikate in Jos, Plateau Stet. Afta dat one, e kon go Universiti of Abuja wia e tek get digre in Biznes Adminstrashon an Masta digre in Policy an Leadership Stodis fom di sem skul.

Politis

Okphebholo trai enta as senator for Edo Centra Senatorial District, onda di All Progressives Congress (APC) an dem elect am on 25 February 2023. On June 13 2023, e dey insaid di senators of 10th Nashonal Assembli of Nigeria, wey dey stan for Edo Centra senatorial district.

In February 2024, na im win Edo Stet APC gubernatorial primari eleshon. Wen dem dey du Campign in 2024, ogbonge Nollywood aktres, Mercy Johnson Okojie sopot Monday Okphebholo.

Na im bi di Govnor elect of Edo Stet onda All Progressives Congress Parti.

Okphebholo mari Blessing Okpapi Ekpe an dia two bon two pikin.E no bi onli politishan an famili man na stil beta christian an memba of Redeemed Christian Chorch of God.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Meet Monday Okphebholo entrepreneur and APC candidate. The Vanguard Newspaper 10 July 2024, Retrieved 23 September 2024.