Margaret Adebisi Sowunmi

From Wikipedia
Margaret Adebisi Sowunmi
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Fest nemMargaret Chenj-am
Wen dem bon am1939 Chenj-am
Ples wey dem bon amKano Chenj-am
Wok wey e dey dubotanist, archaeologist, palynologist Chenj-am
Wu e dey wok forUppsala University, Goethe University Frankfurt, University of Ibadan, University of Ibadan Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Ibadan, St Anne's School, Ibadan Chenj-am
Described at URLhttps://trowelblazers.com/africanarchaeologists/ Chenj-am

Margaret Adebisi Sowunmi (dey bon am September 24, 1939) na Naija wuman wey dey stodi plant (botanist) an e stil dey stodi how wetin human bein dey du don hafet di envaromet (environmental archaeologist). Sowunmi nem bifor e mari na Jadesimi. Sowunmi bi professor of Palynology an Environmental Archaeology at di Yunivasiti of Ibadan. Na Sowunmi stat di mek pipul dey stodi how human hativiti don hafet di envaromet an di stodi of how old old plant wey don kpai don hafet man from wetin rimain of di plant (Paleoethnobotany) in Naija. Di pesin wey fom an stil bi presidor of Palynological Association of Nigeria bi Sowunmi.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Kano wey de Norta Naija dey tek bon Margaret Adebisi Sowunmi on September 24, 1939. Sowunmi papa na pasto of Church of Nigeria. E du e sekondri skul for St Anne Skul, Ibadan an leta kolet e B.Sc satifiket in spesha Botany for di Dipatmet of Botany at Yunivasiti of Ibadan. Na 1962 e kolet e B.Sc satifiket in Botany. In 1963, Sowunmi get chans to go du e Ph.D in Palynology wen e risiv skolaship. Bikos of dis one, E go Sweden to stodis with Gunnar Erdtman wey bi e supavaso. Na for 1967 e get e Ph.D satifiket in Botany at Yunivasiti of Ibadan.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sowunmi wok as a leshura wey don get Ph.D to risach at di "Archaeology Unit" for Institute of Afrika Stodis wey de Yunivasiti of Ibadan in 1967. Na Sowunmi di Naijiria Yunivasiti "Palynology" Laboratori in 1971. E bikom professo of "Palynology an "Environmental Archaeology" in 1982. Dorin Sowunmi wok as leshura, e don go meni hiya skul as visitin leshura. Some of di skul wey e don go as visitin leshura na: di Dipatmet of "African Archaeology", Uppasala Yunivasiti in 1997, di Institute of Archaeology, Yunivasiti Kolej London, an di Dipatmet of " African Archaeology and African Archaeobotany", Johann Wolfgang Goethe-Universität. Wen e dey wok, e supavase seven studet for dia Ph.D satifiket an pipul sabi am as beta tisha wey sabi enkoraj e studet. Sowunmi don wok on mata wey konsain wuman in "Archaeology" in Naija an infat, e don hep chenj somtins for some yunivasiti korse taitu wey tok abaut men for skuls.

Na Sowunmi bi di fonda an presidor of Palynological Association of Nigeria an e stil bi presidor of West African Archaeological Association.

Na in 2004 Sowunmi ritaya.

E risach wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sowunmi don du big tins dorin e risach wey oda pipul neva du bifor an dey bi:

  • Na Sowunmi bi di fest pesin to risach "Identifications of Age and Paleoenvironment of the Gwandu Formation".
  • Na Sowunmi bi di fest pesin to risach " the first descriptions of Eocene pollen of the Ogwashi-Asaba Formation."
  • Na Sowunmi bi di fest pesin to du "stodi of Late Quaternary vegetatation and environmental history of Nigeria"
  • Na Sowunmi bi di fest pesin to stodi "pollen from an archaeological site in Nigeria.

Some of e wok wey e don poblish[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • M.A. Sowunmi. 1972. Pollen morphology of the Palmae and its bearing on taxonomy. Review of Palaeobotany and Palynology
  • M.A. Sowunmi. 1973. Pollen grains of Nigerian plants: I. Woody species. Grana
  • R.J. du Chêne, M.S. Onyike & M.A. Sowunmi 1978. Some new Eocene pollen of the Ogwashi-Asaba Formation, south-eastern Nigeria. Revista Española de Micropaleontología 10(2), p. 285-322.
  • M.A Sowunmi. 1981. Aspects of Late Quaternary Vegetational Changes in West Africa. Journal of Biogeography 8: 457-474.
  • M.A. Sowunmi. 1985. The beginnings of agriculture in West Africa: botanical evidence. Current Anthropology
  • M.A. Sowunmi. 1995. Pollen grains of Nigerian plants: II. Woody Species. Grana 34: 120-141.
  • M.A. Sowunmi. 1998. Ecological archaeology in west Africa : the state of the discipline in ANDAH (B.W.) et al., Africa: the challenge of archaeology. Ibadan, Heinemann Educational Books, pp. 65–100
  • M.A. Sowunmi, 1998. Beyond academic archaeology in Africa: The human dimension. African Archaeological Review