Legend

From Wikipedia

Legend na one katigori of tradishonal tori wey pipo dey tok. Dis tori tok abaut pipo histri, biliv an wetin fit don hapun long time ago. Dis legend tori dey get some lessin abaut life, an some sens wey fit mek pipo biliv di tori . Legend tori dey get mirakul inside sometimes. As time dey go, pipo dey add or komot tins for di sem tori so dat di tori no go just kpai like dat.

Meni legend tori get plenti tins wey no bi true an meni pipo wey dey lisin to am no too dey biliv all of dem. Pipo no fit tok sey legend tori hapun abi e no hapun bikos, nobodi fit get di koret tins abaut di tori. Legend tori difren from some tori wey dey tok abaut spirit or god-dem bikos na pesin histri legend tori dey always tok abaut. Anoda risin wey mek legend tori difren from tori abaut god-dem bi sey, di tori fit konet with one histri wey don hapun bifor bifor.

Legend tori inside kristen rilijion[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bikos meni tori abaut pipo wey woship God dat time dey konet with mirakul, pipo dey put dia tori as legend tori.

Modern legend tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Modern legend tori na di niu niu tori wey pipo wey dey alif tok inside muzik, television an for art. Di modern legend tori no bi true tori but pipo dey tok-am like sey e hapun true true. Di modern legend tori fit mek pesin dey fear or fit mek sombodi laff wel wel. Wen pesin wan mek pipo laff or e wan tok somtin wey pipo go vex for, e go tok am in modern legend tori metod. Pipo fit no too vex if e yuz dis way tok am. Wen pipo no fit esplan wetin hapun like how somtins dey lost, dem go form one legend tori to esplan wetin hapun.