Kanayo O. Kanayo

From Wikipedia

Anayo Modestus Onyekwere (Dem bon am for March 1, 1962) wey pipul no as Kanayo O. Kanayo na Naijá aktor an lorya. Dem bon am for Mbaise in Imo Stat for Naijá.In 2006, e win di Afirica Muvee Akademi Awad for di best aktor fo di pat wey e akt for di fim Family Battle. Di fest fim wey Kanayo akt inside na Living in Bondage.Kanayo don akt inside fim wey pass 100.Kanayo nem dey for aktor-dem wey du wel for 2018 Afirika Muvee Awad for di fim Across the Niger.Kanayo niu fim na Up North an Living in Bondage. Kanayo vilej na Mbaise wey dey Imo Stet.Im bi di sekod boi-pikin an di nomba three pikin for di five pikin wey im papa bon. Di nem wey im famili dey ansar na Onyekwere.Kanayo wife no dey wit am again an na two boiz and two gelz e bon. Kanayo mama dai for 2011, an meni aktor go im mama berial.For 2011, e join oda kontest for di posishon of House of Representatives of Imo stet wit di parti APGA, bot e no win.For 2019 e try again bot lose to e famili memba Mr Martins Emeka Chinedu. Kanayo no tu like Facebook, YouTube, TikTok, Twitter or wetin inglish de kal social media. Kanayo don akt for meni meni Nollywood fim like Lion Heart an Professor JOHNBULL wey e du like pesin wey bi akada.Im bi ambasador for United Nations an get di rank MFR. Wen Naijá bi 100 yess old, Gofment onor meni pipu an im dey tu. Kanayo finish law for University of Abuja for 2018.For2020, e kolet satifikat forNigerian Law School wey dey Bwari.