José Mourinho

From Wikipedia
José Mourinho
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromPortugal Chenj-am
Nem for lokal langwejJosé Mourinho Chenj-am
Orijina nemJosé Mário dos Santos Mourinho Félix Chenj-am
Fest nemJosé Chenj-am
Famili nemMourinho Chenj-am
AliasThe Special One Chenj-am
Nik-nemSpecial One Chenj-am
Wen dem bon am26 January 1963 Chenj-am
Ples wey dem bon amSetúbal Chenj-am
PapaJosé Manuel Mourinho Félix Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokPortuguese, Spanish, Italian, French, English langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football coach, association football player, diplomat Chenj-am
Position played on team / specialitymidfielder Chenj-am
Wie e go skulTechnical University of Lisbon Chenj-am
Member of sports teamRio Ave F.C., C.F. Os Belenenses, G.D. Sesimbra, Comércio e Indústria Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Owner ofÉtoile Lusitana Chenj-am
Awod wey e koletGrand Officer of the Order of Prince Henry Chenj-am

José Mário dos Santos Mourinho Félix GOIH (Dem bon am for January 26, 1963) na profeshional futbol manija an forma futbol playa wey kom fom Portugal.Na im bi di kosh of Seria A klub Roma. Di British midia giv am one nem wey bi di Speshal one an Mourinho na one of di futbol manija wey kolet kop an awod pass for di histri of futbol. Mourinho dey amog one of di futbol manija wey sabi pass in futbol histri. Wen Mourinho sí sey e fit no mek am as futbol playa, e kuku ma plan to bi futbol kosh.Mourinho fest bi interpreta for Sir Bobby Robson for Sporting CP and for Porto. Afta dat time, e kom bi assitans for Robson an Louis Van Gaal in Barcelona. Mourinho kom stat to dey kosh for smol time for Benfica, den e du kosh smol for Uniäo de Leiria too.In 2002, Mourinho bikom di kosh of Porto an Porto kari dia ligi Primeira Liga two time, UEFA Cup an di Champion League.Di last time wey Porto win Champion League bifor Mourinho na 1987.Bikos e du wel for Porto, Chelsea Klub wey dey England kom Chus am as dia kosh in 2004. Mourinho dat time like to dey mek mouth wel wel wen e stat to dey kosh, e tok dey e na "Speshal one" an na day wod dey tek no am til todey.Wen Mourinho stat to dey kosh Chelsea, e hep di klub win 2 Premier League, 1 FA Cup an 2 League Cup for di three sisin wey e tek kosh di Klub Buford e komot for di klub bikos of sey e an di ona get gbenge smol. For 2008, Mourinho go kosh Inter Milan wey dey Italy an e hep di klub win Seria A League two time an wetin dem dey kol Treble ( Champion League, Seria A an Copa Italia for one sisin). Di one an onli klub to du am for di histri of klub in Italy. Mourinho dey amog di five kosh in futbol histri wey don win Champion League wit two difren klub.In 2010, FIFA chuz am as di best kosh in di wold. Mourinho kom go Real Madrid for Spain wey e win La Liga in 2011/2012 wit a rekod point an dis mek am di namor kiba five kosh to win ligi in four difren kontri.Wen Mourinho dey Real Madrid e stil win Copa del Rey an Supercopa de España. Mourinho komot for Madrid in 2013 an join Chelsea again an for Chelsea e win anoda "Premier League" an "League Cup". Chelsea sack Mourinho in 2015 bikos of bad risot. Mourinho chuz to dey England an e stil kosh Manchester United an Tottenham Hotspur.Di time wey e yuz for di two klub no long bifor dey sack am. Wen Mourinho kosh Manchester United, e hep di klub win Europa League, League Cup an FA Community Shield an e hep Tottenham to di final of di League. Roma kom baya Mourinho as dia kosh an e hep Dem win di fest UEFA Europa Conference League.Na Mourinho bi di fest futbol Manija wey don win European Kompetishion wit four difren klub.E stil bi di nomba three manija to win all three major European Klub kompetishion an Mourinho bi di onli manija to win UEFA treble (Champion League, UEFA Cup/Europa League an Europa Conference League. Na Mourinho dey nem di "Portuguese Coach of the Century" by di PFF ( Portuguese Football Federation) in 2015 an e na di fest kosh to spend ova 1 billion pound on transfa. Bikos Mourinho sabi futbol mata wel wel, e sabi du shakara wel wel an bikos e like to win marsh even if e game no too swit, pipul dey kompiam wit Argentina kosh Helenio Herrera