Jasmine Paolini
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Italy |
Country for sport | Italy |
Fest nem | Jasmine |
Famili nem | Paolini |
Wen dem bon am | 4 January 1996 |
Ples wey dem bon am | Castelnuovo di Garfagnana |
Fest langwej | Italian |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | Polish, Italian, English langwej |
Ancestral home | Poland, Gana |
Wok wey e dey du | tennis player |
Wie e dey liv | Bagni di Lucca, Lucca |
Member of sports team | Italy Billie Jean King Cup team |
Sport | tennis |
Singles record | 386–270 |
Doubles record | 82–71 |
Participant in | 2017 Fed Cup, tennis at the 2020 Summer Olympics – women's doubles, tennis at the 2020 Summer Olympics – women's singles |
Jasmine Paolini (dem bon am on 4 January 1996) na Italian profeshonal tennis playa. Shi get WTA rankin of No. 7 in singles, wey e get on 10 June 2024, an No. 13 insaid dobus, wey e get on 1 July 2024.
Paolini don enta final two taims, shi don rish 2024 French open an Wimbledon finals. Shi don win two singles an three dobus title insaid WTA Tour, an WTA 1000 single title insaid 2024 Dubai Tennis Championship. Shi don win two singles titles on di WTA chalenj tour wit nine titles insaid single an one dobus title on di ITF circuit. Na shi bi Italian No.1 female tennis playa.
How e tek stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon am for Castelnuovo di Garfagnana an e gro insaid Carrara an Forte dei Marmi, wey dey Tuscany. Im papa Ugo, na Italian an im mama, Jacqueline, na polish an Ghanian. Im broda Williams, sef sabi pley tennis. Na im papa an uncle hep am fest sabi how to pley tennis wen shi dey five years old. Wen shi 15 years old, shi muv go Tirrenia for training.