Janani Luwum

From Wikipedia
Janani Luwum
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromYuganda Chenj-am
Fest nemJanani Chenj-am
Wen dem bon am1922 Chenj-am
Ples wey dem bon amAcholiland Chenj-am
Wen e kpai17 February 1977 Chenj-am
Place of deathKampala Chenj-am
Manner of deathhomicide Chenj-am
Place of burialKitgum District Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupriest Chenj-am
Post wey e deybishop Chenj-am
Wie e go skulSt John's College, Nottingham Chenj-am
RilijonAnglicanism Chenj-am

Janani Luwum (dem bon am for 1922 and e kpai for Febuari 16, 1977), wey dem sabi as Janani Jakaliya Luwum, na di lait Akbishop of di Church of Uganda from 1974 to 1977.

For 1971, Idi Amin bin tek ova pawa by force from Milton Obote. Wen e dey in pawa, e yuz im pawa tek kpai meni pipul and som jos dey miss for di kontri.

Janani Luwum, wey bi di Akbishop of Uganda for dat taim, nor dey hapi wit di way pipul wey go against Idi Amin jos dey miss. Im posishon as di Akbishop of Uganda mek e dey hard for am to shut up ova di mata of harsh lidaship of Idi Amin. So, togeda wit orda relijos figors for di kontri, e bin rait one serious leta of protest to Idi Amin, wie e tok sey mek Idi Amin stop all di bad tins wey e dey do to im pipul.

Wen Idi Amin receive di message, e feel sey dem don insult am and e arrest Janani Luwum and quickli arenj wayo trial for am wey find am guilti. Na so di Akbishop Janani Luwum tek kolet bulet wotowoto from Idi Amin men for Febuari 1977.

Since 2015 Uganda dey do poblik holide for evri 16 Febuari, to selibrate di laif of Janani Luwum, wey Isaiah Ogedegbe don kol "di man wey neva mek peace wit oppreshon".[1]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Isaiah Ogedegbe (19 November 2021). "Janani Luwum: The Man Who Never Made Peace With Oppression -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. Retrieved 10 June 2023.