Isreal Adesanya

From Wikipedia
Isreal Adesanya
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNew Zealand, Naija Chenj-am
Orijina nemIsrael Mobolaji Temitayo Odunayo Oluwafemi Owolabi Adesanya Chenj-am
Fest nemIsrael Chenj-am
Famili nemAdesanya Chenj-am
Wen dem bon am22 July 1989 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Wok wey e dey duboxer, kickboxer, mixed martial arts fighter Chenj-am
Sportmixed martial arts Chenj-am

Isreal Mobolaji Temitayo Odunayo Oluwafemi Owolabi Adesanya (dem bon am for 22 July 1989) na New Zealand Ogbonge maritial aktist, kick boksa an bifo-bifo boksa. For im wok e dey fait insaid midle weight divishon in di Ultimate Faight Championship (UFC), Wia e bi forma two-taim UFC middle weight champion. In kick boksin, na im bi di forma Glory middleweight championship taitu chalenja. In May 21 2023, e don bi #5 for UFC pound-for-pound rankin.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Adesanya for Legos, Nigeria, na im sinior pas insaid five pikin wey im papa an mama bon. Im papa, Olufemi na akountant an im mama, Taiwo, na nors, Adesanya go Chrisland skol, Opebi, an stat Taekwondo afta skol klub bifor im mama komot am for dia bikos of injuri. In 1999 e go Ghana wit im famili for ten month. E papa an mama send am go Rotorua, New Zealand, to get beta edukashon wen e dey 10 years old. Adesanya no tu lik to dey fait wen e dey High Skol, but e lik Japanese anime.

Wen Adesanya finish for High skol e kon go get Bachelor of Science in computer Design for Universal College of Learning in Whanganui. Wen e dey 18 years old, e stat to dey len kik boxin, afta e luk Muay Thai fim Ong-Bak. Afta 2 years e stop to dey len buk go dey di kick boxin.

Adesanya sabi spik plenti langwej, e sabi Yoruba, Nigerian Pidgin and English.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor e stat to dey du boxin, Adesanya dey dans for plenti kompetishon for New Zealand. E tel pipu sey e lik to dey dans for wokout of UFC 243.

Insaid September 2020, e du kontrat wit Puma.

In June 2023, dem du fim abaut Adesanya, Styleblender, wey dem sho for Tribeca Film Festival.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Nigeria Adesanya beats Whittaker to become undisputed middle weight champion. The Guardian Nigerian News 6 October 2019.

2. Israel Adesanya the pain behind rise to the UFC. Sporting News. 9 February 2018. Retrived September 22 2023