Inumidun Akande

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Inumidun Akande
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am10 June 1947 Chenj-am
Wok wey e dey dulawyer Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am

Inumidun Akande (dem bon am for June 10, 1947) na Naijá loyar an bifor bifor jorge wey big pass for Legos Stet.

How e take stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Inumidun stat pamari skul for Holy Trinity Primary School for Ebute-Ẹrọ, one big siti wey dey inside Legos Stet for Naijá. Afta e finish pamari skul, e go Ijebu Ode Grammar School in Ogun Stet wey dey Naijá for e sekondiri skul an pass e WAEC (West Africa School Certificate) in 1966.Inumidun go univasiti of Legos go rid law an e pass out wit one satifikate wey dem dey giv for univasiti wey bi bachelor's digri in Law in 1970. Inumidun pass out for di skul wey pesin most go if pesin wan bi loya wey dem dey kol Law Skul in 1971. Inumidun stat to dey kari kase go kot on June 16,1971.

How e tek stat wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Inumidun Join di pipul wey dey esplan, dey difend an dey apply law for Legos Stet in early 1970s an Inumidun wok for the ofis of Justice. E bi di dareto for di ofis wey dey rait law giv pipul wey go kom put am for law for Legos Stet. Inumidun kom get transfa to di Nashonal Assembly for Legos as di sekond Oga for di grup wey dey fom law giv pipul wey go put am for law in 1989. For September 8,2009 dey chuz am as di shif Judge of Legos Set two years afta Babatunde Fashola don be Govnor for Legos Stet. Di time wey e bi 65 years old, Inumidun stop to dey wok and dat day wey e stop to wok for govment bi June 10, 2012. Ayotunde Phillips kom tek ova e posishon as di 14 pesin wey don bi shif Judge of Legos Stet.