Ifeanyi Ubah
Part of | Nigerian senators of the 9th National Assembly |
---|---|
Man abi wuman | man |
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Ifeanyi Patrick Ubah |
Orijina nem | Ifeanyi Patrick Ubah |
Fest nem | Patrick |
Official name | Patrick Ifeanyi Ubah |
Wen dem bon am | 3 September 1971 |
Ples wey dem bon am | Nnewi |
Wen e kpai | 27 July 2024 |
Manner of death | natural causes |
Cause of death | cardiac arrest |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | politician, entrepreneur, businessperson |
Post wey e dey | member of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria |
Party wey e dey for politis | Peoples Democratic Party, Young Progressive Party |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Owner of | Ifeanyi Ubah F.C., The Authority (newspaper) |
Personal pronoun | L485 |
Patrick Ifeanyi Ubah (dem bon am on 3 September 1971 - 27 July 2024), na Naija politishan, biznesman an e dey sarf as senator wey stand for Anambra Sauth Senatorial District insaid di Nigerian Senate. Na im bi di CEO of Capital Oil (CCO), wey e stat in 2001. Capital oil dey popula wel wel for Sautheast an Sauthwest of Nigeria an e get one big Tank farm for petroleum insaid Legos.
How e tek stat life an edukashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon as first pikin insaid seven pikin wey Mr. an Mrs. Alphonsus Ubah in Otolo, wey bi one of di four quata of Nnewi insaid Anambra State, Nigeria. Im papa an mama no fit pay skul fees for am wen e dey go Priemere academy, Lugbe, Abuja, e kon go len how to sel tins for smol. E go plenti difren seminar an biznes courses ontop leadership an biznes management.
Bizness
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ifeanyi dey kari motor tyre an spare pats go anoda kontri for West Afrika lik; Ghana, Sierra Leone, Liberia an DR Congo e leta kari am go som kontris for Europe lik Belgium an di United Kingdom. Insaid 2001, e stat Capital Oil an Gas Limited. Na im stat Authority Niuspepa, wey bi Naija Niuspepa an na im get Ifeanyi Ubah F.C., wey bi Naija Premium League futbol team,e buy am fom as Gabros Intanashonal Futbol Klob.
Politis
[chenj-am | chenj-am for orijin]Insaid 2014, Ifeanyi Ubah luz for Anambra gubernashonal eleshon onda Labour Party. On 24 February 2019, na Ifeanyi Ubah dem anous sey e win di Anambra Sauth Senatorial eleshon onda di Young Progressive Party (YPP), e leta join All Progressive Congress (APC).
Pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ifeanyi Ubah mari Uchenna Ubah, wey bi Biznes Management graduate fom Ahmadu Bello University in Nigeria, dia two bon five pikin togeda. E get foundation wey kari im nem; Ifeanyi Ubah Foundation.