Habeeb Okunola

From Wikipedia
Habeeb Okunola
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am2 August 1981 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Wok wey e dey dubusinessperson Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am

Iba Akosin Habeeb Okunola OFR, MON, FICA ( dem bon am on 2 August 1981) na Naija biznes pesin, wey dey lik put moni for biznes an e dey lik hep pipu, na im stil bi di cheif exekutiv offisa of TILT Grup, na one big kompini wey get big offis for Nigeria.

Hau e tek go skul an stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

E go Santa Marie Skul wey dey Legos Stet for im primari edukashon an kon du im sekondri edukashon for Community Grammar Skul, wey dey Surulere, Legos. Afta smol taim, e go Universiti of Legos wia e tek get Bachelor of Science (B.sc) digre in Philosophy insaid 2006. E go Havard Business School an London Business School for exekutiv Edukashon Programme.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

E travu go United Kingdom in 2007 afta e finish im fest digre. Wen e dey United States e wok wit Grovetex Consulting as Biznes Divelopmet Offisa. E kom Nigeria kon stat im fest kompini, Habtob Global Ventures in 2009. E no stop to dey du wel for di wey e dey put moni for biznes sotey e stat TILT Construction, wey bi pat of TILT Grup in 2012.

Sins dat taim na im dem don sabi am as one of beta kompini wey dey di wod, TILT kompini don du biznes wit private an poblik organisashon to giv dem beta tins lik;.330 KVA Transmishon line, na dem du Kaduna Hauz of Assembly wel wel, na dem du beta art wok for Ilorin, Kwara Stet, an som oda ones.

Hau e tek hep pipu[chenj-am | chenj-am for orijin]

Iba Habeeb Okunola don dey trai hep pipu wit I'm organisashon, wey mek am stat Habbeb Okunola Foundation, e stat am to dey folo govmet dey du soshial jostis.

Nashonal honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid 2022, Habeeb Okunola kolet nashonal honor - memba of di Order of di Niger by President Muhammadu Buhari ontop hau e tek dey du im servis.

Insaid 2023 dem giv am nashonal honor of Offisa of the Order of di Fediral Repoblic (OFR) bikos of di beta way e dey uze sarf do kontri.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Im na fest klass chief in Nigeria. Na im bi di Akosin of Yorubaland, an Aare Tayese of Iseyinland. Som oda awods na:

. Officer of the Order of the Federal Republic (OFR) by President of di Fediral Repoblic of Nigeria, His Excellency Muhammadu Buhari GCFR

.Member of di Order of the Niger (MON) by President of di Fediral Repoblic of Nigeria, His Excellency Muhammadu Buhari GCFR

.National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) Ambassador of War Against Drug Abuse.

.Forbes Best of Afrika Outstanding Entrepreneur Awod.

.Euro Knowledge Leadership Award at di Hauz of Lords, UK

.Awod for Excellence and Biznes Innovashon at di 6th Annual Nigeria Entrepreneurs Awods

.Omoluabi awod for “Integrity in Conduct.


.ECOWAS Youth Council’s Distinguished African personality.

.Excellence in Biznes Leadership an kommunity Divelopmet.