Godman Akinlabi
Godman Akinlabi(bon 28 December 1974) na Naija pastor, raita, poblik spika an enjinia. Na e bi di lid pastor of "The Elevation Church" .
How e stat life and edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Godman Akinlabi for December 28, 1974 an e kom fom Igbo-Ora, Oyo Stet South-westa pat of Naija.Akinlabi gro up for Ibadan, wie e go Government College, Ibadan, Oyo Stet, Naija from 1985 go fish 1990.E kom go rid Mining and Mineral Engineering for Federal University of Technology Akure, Ondo Stet for 1992. For wie e kolet Bachelor of Technology (B.Tech.) in 1997.Akinlabi kom du e Masta digri in International Diplomacy at di University of Lagos.Akinlabi bi forma studet for Manchester Business School, England,for wie e du e MBA.
Pastoral ministri
[chenj-am | chenj-am for orijin]Abimlabi stat e pastoral ministri for Daystar Christian Centre as a usher, pastor, tisha, prisha, datetky of pastoral kia and di faculty of Daystar Leadership Academy Wie e lid Leadership Development Courses"_ for twelve years. On 10 October 2010, di senior pastor of Daystar Christian Church"', Sam Adeyemi, commission "The Elevation Church" wey Godman bi di lid pastor. For July 2016, im launch "BelieversConnect", wey bi one applikashion wey dem divelop to konet singu Kristen "wey get di di sem mind for gud marej" . Base on e prishi, e bi one of di pastor wey get mouth for Naija.
Buk wey e don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin]Akinlabi don rait meni buk like:
- The 7 Commandments of Foolishness, April 2014
- Sexuality: Get a Grip (Singles)
- Sexuality Get a Grip (Couples)
- Don't Waste Your Pain
- Moving from Fear to Faith
- I am Possible
- Burning Questions, Flaming Answers