Ghost train

From Wikipedia
Emajinashon of how ghost train fit be like

For tradishonal tori, Ghost train na one emajin motor wey dey move wey bi like train. Dis "Ghost train" dey difren from eni oda tin wey ghost or spirit dey de bikos di one dey waka from one ples to anoda. Na evri wie inside di train you fit see di ghost.

Wie di tori don rish[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni ples wey train don dey pass bifor get one or two tori abaut "Ghost train". Kontri like Canada, Japan, Sweden, UK, an meni state for USA all get tori wey tok abaut "Ghost train".

Japan: Tanuki Versus steam trains[chenj-am | chenj-am for orijin]

For Japan, nisekisha or yūreikikansha na one tradishonal tori-dem wey tok abaut fake, or emajinin or ghost stim train wey kova di "tanuki".

Di tori dey popula wel wel in di 1910. One pesin wey dey rait an tok abaut tradishonal tori, Kizen Sasaki tok abaut am in 1926. E tok sey " Evribodi go don hie dis kind tori at list one time."

Kizen Sasaki tok sey di fest time wey e fit folo an trace di tori na from 1879 go rish 1887. E tok sey na wen Japan pipo start to dey yuz train as transpoteshon na di sem time di tori start to dey popula.

With wetin Sasaki tok, e tok sey di "Ghost train" na for pesin to jos yuz am laff wen we kompiye-am with Japan tradishonal tori abaut Ghost ship wey fit mek pesin mind fear wel wel. Sasaki tok sey di wetin di tori dey abaut na: Wen driva wey dey drive train dey do dia wok, dem go hie di noise sey anoda train dey waka for di sem lane wey dem sef dey drive an dis one go mek dem stop do train. Afta somtimes, di driva no go see eni train an dis one go mek dem kontiniu dia jorni onli to kontiniu dia jorni an see sey one tanuki wey bi hanima don kpai for di lane wey dia train wan pass.