Gayle Wald

From Wikipedia
Gayle Wald
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromAmerika Chenj-am
Fest nemGayle Chenj-am
Famili nemWald Chenj-am
Wen dem bon am25 October 1965 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duraita, literary scholar, folklorist Chenj-am
Wu e dey wok forGeorge Washington University Chenj-am
Wie e go skulPrinceton University, University of Virginia Chenj-am
Awod wey e koletGuggenheim Fellowship Chenj-am

Gayle Wald na professo of Inglish an Amerika stodis at di George Washington Yunivasiti an e stil bi Guggenheim Fellow. Wald na di visitin Assistant Professo of Inglish an Amerika stodis at Triniti Kolej in Hartford Connecticut from 1994 go rish 1995.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wald finish wit BA satifiket in Inglish an French from di Yunivasiti of Virginia in 1987. Wald kom du Ph.D in Inglish from Princeton Yunivasiti in 1995

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wald dey wok as Professo of Amerika Stodis for George Washinghton Yunivasiti. Bifor, e na oga wey dey kontro Inglish dipatmet bot na Wald dey kontro Amerika stodies for di Yunivasiti Wald dey among di editor of di poblikeshon "Journal of Popular music Studies".E stil dey rait for Niuz Pepa an blogs Wald stil dey among di editor of "Bloomsbury':"

Buk wey e don rait[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Crossing the Line: Racial Passing in U.S. Literature and Culture (Duke University Press, 2000)
  • Shout, Sister, Shout!: The Untold Story of Rock-and-Roll Trailblazer Sister Rosetta Tharpe (Beacon Press, 2007)
  • It's Been Beautiful: Soul! and Black Power Television (Duke University Press, 2015)

Di buk "Shout, Sister, Shout! na e dey tek mek di dokumentari fim "Sister Rosetta Tharpe: The Godmother of Rock & Roll," wey Mick Csaky daret. Na stil "Shout, Sister, Shout! na e dey stil yuz tek mek di muzikal fim wey Randy Johnson daret; buk by Cheryl L. West. Na di muzikal fim deys tek opun di Pasadena Playhouse in July 2017 an di Seattle Repertory Tihata in November 2019. Anoda muzikal wey George Brant du Marie and Rosetta stil yuz di tori wey dey Shout, Sister, Shout!. For September 2019, Beacon rilis di ordiho buk of Shout, Sister, Shout! an Leslie Uggams tok inside an na Elizabeth Healy produs am. Wald dey rait a buk wey konsain Ela Jenkins. Ela Jenkins na Muzishan wey dey sing for smol pikin-dem.

Awod wey e don kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • John Simon Guggenheim Memorial Foundation Fellowship, 2012–13
  • National Endowment for the Humanities Fellowship, 2012–13  
  • National Endowment for the Humanities Fellowship, 2005-6

Wald don kolet two Nashonal awod. Di nem of di awod na Nashonal Endowment for di Humanities Falkoti Feloship: e kolet one in 2005-2006 an di sekod one e kolet in 2012-2013. Gayle Wald stil don kolet John Simon Guggerheim Memorial Foundation Fellowship. E kolet dis one in 2012-2013.