Foluke Daramola
| Industry | film industry |
|---|---|
| Man abi wuman | wuman |
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Nem for lokal langwej | Folúkẹ́ Dárámọ́lá–Sàlàkọ́ |
| Orijina nem | Foluke Daramola |
| Fest nem | Foluke |
| Famili nem | Daramola |
| Wen dem bon am | 15 February 1978 |
| Ples wey dem bon am | Ekiti State |
| Pesin wey e mari | Kayode Salako |
| Pikin | Ibukunoluwa Ayomikun Owolabi |
| Fest langwej | Yoruba Langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
| Langwej wey e tek rait di wok | English langwej, Yoruba Langwej |
| Wok wey e dey du | film actor, film producer, television actor, actor, film director |
| Pat of wok wey e put mind | theater arts |
| Wie e go skul | Obafemi Awolowo University, Ikeja Senior High School, University of Lagos |
| Wen e stat wok | 1998 |
| Rilijon | Christianity |
| Hair kolor | black hair |
| Eye kolor | brown |
| Influenced by | Tunde Kelani, Amaka Igwe, Lola Fani-Kayode |
| Nominated for | Africa Movie Academy Award for Best Actress in a Supporting Role |
| Personal pronoun | L484 |
Foluke Daramola-Salako na Naija aktres. Shi dey insaid aktres wey dem rait im nem to kolet Afrika muvie Akademik awod for Best Aktres in a sopotin rol in 2013. Na Yoruba Naija aktres an shi dey produs fim.
Hau shi tek stat life an wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Daramola on 15 February 1978. Shi finish fom Obafemi Awolowo University. In 1998, shi du im fest fim wey bi Palace. Shi akt insaid Durodola an Above Law. In 2016, im pikin wey bi girl na host for one TV sho. Im fim, Cobweb, wey shi du giv am chanz to dey insaid aktres wey fit win Afrika Muvie Akademik Awod bes sopotin aktres norminashon. Shi tok sey di fim wey shi du na abaut im life tori bikos im papa an mama no wan mek shi dey du fim. Na shi stat "Action Against Rape in Africa", wey dem du to komot rape an trai mek don sho pipu wey trai am shege for Afrika.
Im pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]In 2016 intaview, shi tok sey dem rape am wen shi dey smol. Insaid one tok tok wit Tribune, shi tok sey wuman sopos no sey dem dey impotant an dem no sopos no dey liv ontop dia hosband moni. Shi tok hosband wey dey du dia waif enihau, an sey dat one pas mek hosband dey folo anoda wuman outsaid. In 2017, Shi tok abaut Aliko Dangote as pesin wey dey humbu pas for di wod.
In March 2018 intaview wit The Punch, Daramola Salako tok sey shi ci im big boobs as plus for am, sey plenti man lik am bikos of am. Shi tel oda wuman mek dem no dey shame for enitin, mek dem no sey na plus for dem.
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]1. How Foluke Daramola became a Nollywood star. PM News. Retrieved March 16 2024.
2. "Most rape victims don't turn normal adults - Foluke Daramola". Vanguard. Retrieved 14 November 2023.