Aliko Dangote

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Aliko Dangote
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAliko Chenj-am
Wen dem bon am10 April 1957 Chenj-am
Ples wey dem bon amKano Chenj-am
Broda an sistaSani Dangote Chenj-am
PikinIcham nafion Dagonte, Nafion icham Dangote, Fatima Dangote Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Arabic Chenj-am
Wu e dey wok forDangote Group Chenj-am
Wie e go skulAl-Azhar University, Government College, Birnin Kudu Chenj-am
Wen e stat wok1977 Chenj-am
AffiliationDangote Group Chenj-am
Affiliation stringDangote Group, Dangote Industries Limited Chenj-am
E pipul Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Memba ofAmerican Academy of Arts and Sciences Chenj-am
Official websitehttp://www.dangote-group.com/ Chenj-am

Aliko Dangote GCON (dem bon am for April 10, 1957) na Naijá bizness man an pesin wey dash pipul moni an propati. Na im bi di chairman and oga pata-pata for Dangote Group wey bi difren-difren kompini an na im get moni pass for di hol Afrika.Dangote bi di pesin wey get moni bikos for September 2021, rekod sho sey e get moni an propati wey rish $12.4 Billion Dolla.

How im tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Aliko Dangote na Hausa man wey kom from Kano for insaid Kano Stet. Dem bon am on April 10, 1957 for insaid one muslim famili wey get moni well-well. Im Papa nem na Mohammed Dangote an im Mama na Mariya Sanusi Dantata, di female pikin of Sanusi Dantata. Na Aliko Dangote bi di grand-pikin of Alhassan Dantata, wey get moni pass for West Africa bifor e kom dai for 1955. Sheikh Kumasi Madrasa na di skul wey Dangote go, an e stil go Capital High School for Kano. Wen e stil dey smol, e tok sey: I fit rimemba di taim wey I dey pamari skul, I dey go bui cartons of sweets (Candy) an I go stat to dey sell dem so dat i go fit mek moni. I laik bizness wel-wel, even for dat taim. For 1978, E finish fom di Government College, Birnin Kudu. E kolet Bachelor's degree in bizness stodies and administration from Al_Azhar university, Cairo.

About im bizness[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nigeria[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 1977 dem stat di Dangote grup laik smol bizness an na di sem year Dangote komot fom wia e dey bifor an go bak to Legos to mek di kompini big. Today, e don big an e get plenti moni an stil dey wok for oda kontri laik Benin, Ghana, Naijá, Zambia an Togo. Di bizness wey Dangote dey du wel wel na fud bizness, sement bizness an freight. Na Dangote grup stil bi oga for pipul wey dey du sugar for Naijá an na im stil dey gif am to plenti kompini wey dey du soft drinks laik beer an pipul wey dey yuz am. Di Dangote grup don komot fom kompini wey dem just dey bui an sell tins, but na dem bi di kompini wey big pass for Naijá an dem dey du shuga, sement an Dangote flour. For July 2012, Dangote go mit Nigerian Port Authority an tel dem sey mek dem rent their land gif am, an dem gree. Na dia e kom build im flour kompini put. For 1990, e go mit Central Bank of Nigeria an tel dem sey mek im transportation business dey manej dia staff bus, an dem gree. E stil dash Nigeria Sport Ministry moni so dat dem go fit repair di Nashonal Stadium wey dey for Abuja. For Naijá today, Dangote Grup don tek ova Sugar Market an Refineri Bizness an na im dey gif plenti kompini wey dey du Soft Drinks, Breweries an plenti pipu wey dey yuz Sugar for difrent-difrent way. (Na im dey gif out 70% of Sugar for di hol Naijá). Na im Refineri big pass for Afrika an na im stil bi di nomba 3 for di hol Wold, an e dey produs 800,000 tonns of Sugar evri year. Dangote Grup still get kompani wey dey du Salt, Flour Mills an dem still dey import Rice, Fish, Pasta, Cement an Fertilizer. Di kompini still dey kari Cotton, Cashew Nuts, Cocoa, Sesame Seeds an Ginger go meni kontri wey dey outside. E still dey du Oda important Bizness laik Real Estate, Bankings, Transportation, Textile, Oil and Gas. Na more dan 11,000 pipul dey wok for Dangote kompini an na di kompini big pass for West Afrika. Dangote don dey enta Telekominikashion bizness an e don dey du waya wey e long rish 14,000 kilometers so dat e go fit yuz am for di hol Naijá. Bikos of all dis one, for January 2009 dem trowey salute gif Dangote sey e try as e gif plenti pipul wok for Nigeria Construction Industry. E don tok sey:" Mek I tell una an I go still tell una egein sey notin gud pass to bring kontri moni kom bak to kom spend am for di kontri. If you gif me 5 Billion Naira today, na for Naijá hie I go yuz am du bizness no bi for anoda pesin kontri. So mek wi join hand togeda wok".

Odas tins wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Dangote bi di bak-bone of Olusegun Obasanjo for di eleshion wey e du for 2003, na im mek am gif am moni wey pass 200 Million (US$2 Million). E giv 50 Million Naira (US$500 Thousand) to di National Mosque bikos Obasanjo an Atiku na im frend dem. E still gif ₦200 Million to di Presidential Library. Di gift wey e dey gif PDP parti pipul plenti so tey pipu kon dey komplain sey mek magomago wey di Presido promis sey e no go dey no go folo dia enta di kontiri oo. For 2013, Bloomberg Billionaires Index sho sey e don add $9.2 Billion to di moni an propati wey e get an na dat one kom mek am di nomba 30 pesin wey get moni pass for di hol Wold an na im get moni pass for Afrika. For 2014, Naijá Gofment tok sey Dangote don dash Naijá 150 Million Naira ( US$750,000) mek dem yuz am tek fight Ebola. E stil dash Naijá 200 Million Naira (US$500,000) mek dem yuz am tek fight Coronal Virus (COVID19) so dat e no go kil pipul finish. Na Aliko Dangote an Femi Otedola stil promis sey dem go gif di Super Eagles Of Nigeria US$75,000 if dem skore goal for African Cup Of Nation(AFCON). Na Arsenal fans Dangote bi an e tok sey e wan bui di futbol klub, na Ingland di futbol klub dey.

Im famili laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dangote dey lif for Legos insaid Naijá. E don marri 2 taim an im waif dem don liv am go. E get 3 gel pikin dem wey día nem na Mariya, Halima, Fatimah an 1 boi pikin wey no bi im bon am bot na im dey tek kia of am, an di pikin nem na Abdulrahman Fasasi.

Awods an Grups Dem Wey E Dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

Awods wey dem tek trowey salute gif am[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Dem gif Dangote di sekond awod wey hi pass for Naijá wey bi di Grand komanda of di Order of the Niger (GCON) by president Goodluck Jonathan.
  2. Dem nem Dangote as di Forbes Africa Person of the Year for 2014.
  3. For six years wey bi 2013, 2014, 2015, 2016, 2017, an 2018 Forbes kaunt am as di "Most Powerful Man in Africa".
  4. For 2014, Im dey among CNBC's "Top 25 Businessmen in the World" wey chenj di wold for 100 years.
  5. For April 2014, Time Magazine kaunt am amog di 100 most influential pipul in di wold.
  6. For October 2015, Dangote dey amog "50 Most Influential Individuals in the World" by Bloomberg Markets.
  7. Im win "Di Guardian Man of di Year 2015".
  8. Im win di "2016 African Business Leader Awod" wey di Africa-America Institute (AAI) organize.
  9. Dangote dey among di top 100 most influential Africans by New African magazine in 2015, 2017, 2018 and 2019.

Di difren difren grup wey e join[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dangote na oga for Cooperate Council On Africa, an e stil bi memba for di Steering Committee Of United Nations-Secretary-General's Global Education First Initiative. Dangote stil dey Clinton Global Initiative an di International Business Council of the World Economic Forum. Dem gif am oga for US-Africa Business Center, for September 2016, na US Chamber Of Commerce mek am di oga. For April 2017, e stil join di pip wey dey kontrol di Chinton Health Access Initiative. E stil dey kontrol one grup wey dey du kampen.