Ethiop Eas

From Wikipedia

Ethiop Eas bi erea wey dey for di central senatorial distrit of Delta State, Naijeria. Di erea get e own lokal govment wey wi also kom to sabi as Ethiop Eas lokal govment wey bi hom to tri distrits and 67 setulments. Agbon, Abraka, and Isiokolo bi di distrits for Ethiop Eas and Isiokolo bi whe di lokal govment administrashon sekreteriat dey.

E kova an erea of 380.00 km2 and a populayshon of 200,792 persons akordin to di 2006 census. Di postal koud of di erea bi 330.[1]

Referens[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "Post Oficis- wit map of LGA". NIPOST. Archived from the original on 2012-11-26. Retrieved 2009-10-20.