Dosu Joseph

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Dosu Joseph
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Fest nemJoseph Chenj-am
Wen dem bon am19 June 1973 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbuja Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitygoalkeeper Chenj-am
Wie e go skulIgbobi College Chenj-am
Member of sports teamBridge F.C., A.C. Reggiana 1919, Nigeria national football team Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Participant in1996 Summer Olympics Chenj-am

Joseph Dosu (dem bon am for June 19, 1973) na Naija pesin wey don kash futbol (goalie or gokipa) for Naijá bifo. Na Abuja dey tek bon am.

Im wok for klob[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Dosu Joseph bi di gokipa wen Julius Berger win di Nigerian FA Cup wey dem plai for November 1996. For dat final mash, Katsina United tim no see one goal for di final bikos na Dosu dey goalie.One big car assident wey Dosu get for Legos in 1997 mek Dosu no fit waka again bikos of dat assident. Afta di Olympic game wey dem plai for 1996, Dosu Joseph kom go join bodi wit Serie A klub wey get di nem Reggiana.Dosu no tu plai for Italy bikos e get one serious moto assident wen e bi 23 years old.

How e tek kip for Naijá[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Dosu bi di onli kippa wey dey chuz go 1996 Olympic game wey neva kip outside Naijá for di 3 kippa-dem wey Naijá kari go di game. Afta e hep Naijá win Gold for Olympics, Dosu stil kip for di November 1996 FIFA World Cup kolifaya wey Naijá win wit Burkina Faso 2-0. Leta, e plai wit Morocco for December 1997. Di one wey e stil plai na di Kenya own an dem yuz 1-1 tek end dat mash.Na dat mash bi e las game.

Im wok as pesin wey dey tish pesin how to plai bol[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 2009 im stat to tish pipul how to plai bol, an na im bi di oga for di futbol Akademi wey dey Legos kol Westerlo Football Academy.

Notes[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]