Doris Simeon
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Doris Simeon |
Orijina nem | Doris Simeon-Ademinokan |
Fest nem | Doris |
Ples wey dem bon am | Lagos |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
Wok wey e dey du | actor |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Personal pronoun | L484 |
Doris Simeon (dem bon am for July 22 1980) na Naijá aktres, MC, hairdiresa, an person wey get biznes. Doris bi di pesin wey get Davris Beauty Center wey dey Ifako for Lagos.
Tori about e wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Doris bi wan bikom pesin wey dey tok niuz, bot chenj im mind wen e frend tel am to go see if dey go chuz am for Papa Ajasco wey Wale Adenuga Production produse. Na papa Ajasco bi di fim wey e tek stat to dey akt. Doris fit akt for Yoruba an Inglish fim wel wel.Afta Papa Ajasco TV sho, Doris akt insaid Oloju Ede, Alakada, Ten Million Naira an Modupe Temi.Doris dey insaid Eti Keta tu. For 2010, E akt Da Grin galfrend for di fim Ghetto Dreamz an Doris dey amog produsa for Omo Iya Kan. Wen Doris wan stat to dey akt Muvee, na lait muvee dareto Yomi Ogunmola fest giv am pat to akt.
Fim wey e don akt
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Eti Meta
- Oloju Ede
- Alakada
- Ten Million Naira
- Abani Kedun
- Iseju Marun
- Omo Iya Kan
- Ghetto Dreamz
- Silence
- Gucci Girls
- Omo Pupa
- Asiri
- Modupe Temi
Awod
[chenj-am | chenj-am for orijin]- 2008 AMAA awods Best Indigenous Aktres Onitemi.
- 2010 Zafaa Awod Best Aktres Indigenous Asiri.
- 2015 All Youths Tush Awod AYTA Role Model (Movie) Awod
Pasona life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Doris bin dey marri Daniel Ademinokan wey bi produsa an dareto bifor di marej skata for May 2013.Doris get one pikin for Daniel Ademinokan an di nem of di pikin na David.