Dino Melaye

From Wikipedia
Dino Melaye
pesin
Part ofHouse of Representatives of Nigeria Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemDino Chenj-am
Famili nemMelaiye Chenj-am
Wen dem bon am1 January 1974 Chenj-am
Ples wey dem bon amKano Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria, member of the House of Representatives of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University, Baze University Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
Official websitehttp://www.dinomelaye.com/ Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Dino Melaye (dem bon am on 7 January 1974) na Naija politishan an forma senato an e bi forma memba of di 8th Nigerian Nashonal Assembly, wey dey stand for Kogi West Senatorial district. E kom fom Ayetoro Gbede wey dey Ijumu Lokal Govment Aria of Kogi Stet.

Dino Melaye na forma senato an memba of di Haus of Representatives an memba of di People's Democratic Party, In 2015, e komot for People's Democratic Party to go join All Progressive Party (APC) e leta go bak to PDP wen 2015 eleshon wan hapun. Na im bi di forma chairman Senate Committee on Federal Capital Territory (FCT) Abuja. Na im bi di tok tok pesin for People's Democratic Party candidate, Atiku Abubakar.

Hau e tek stat life an skol[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Dino Melaye for Kogi Stet, Nigeria. E go Abdulaziz Attah Memorial College, Okene for im sekondri skol edukashon. E finish fom Ahmadu Bello Universiti, Zaria wia e go stodi geography. Na im bi di forma leader for Nashonal Association of Nigerian Student (NANS) an leta bi di Secretary-General of Afrika Youth Council.

Politika life[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2015, e go join People's Democratic Party, wia e tek enta as memba of Haus of Representatives wey stand for Kabba/Ijumu fediral constituency. Insaid di 2015 senatoria eleshon e enta as memba of di senato of Nigeria fom Kogi West.

E dey insaid pipu wey sopot Senato Bukola Saraki as pesin wey fit sarf as President of di Senate afta Ahmed Sani Yarima don mention Senato Saraki nem.

Senato Dino Melaye lus to Smart Adeyemi, wit 20,00 votes gap, insaid eleshon wey INEC leta kansu bikos of wahala wey hapun an wuruwuru wey hapun wen di eleshon dey go on. INEC kon du anoda eleshon, dem put am for 30 November 2019, plenti pipu don tok sey Dino Melaye no go du di eleshon, but e komot go vote on dat day.

Plenti pipu no gree go vote, bikos dem dey tink sey wahala go hapun. Senato Smart Adeyemi win Dino Melaye wit big gap like di fest one. Som pipu tok sey na wuruwuru an say na di Stet Govment hep am win. Smart Adeyemi kon enta sworn in to reples Dino Melaye by di Senate President.

Hau e tek trai enta as Governor

Dino Melaye trai enta as Kogi Stet Govnor insaid gubernatorial elshon wey hapun on 16 November 2019. On 3 September 2019, e lus for Primari eleshon, na im kari third posishon. Pesin wey win Engr. Musa Wada uze 70 votes gap am, di wina get 748 votes.

Na Dino Melaye win di 2023 People's Democratic Party (PDP) governorship primari eleshon for Kogi Stet, an im deputy na Hon Habeebat Deen.

Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Melaye no mari for nau. E Mari Tokunbo Melaye for ten years bifor. Tokunbo Melaye komot for Melaye haus bikos e go kourt sey Melaye dey du am enihau for haus. Tokunbo bon 3 pikin for Melaye.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Melaye don win plenti awords, like; Global Youth Awareness and Development Initiative, Protector of the Youth P.D.P National Youth Vanguard, Epitome of Servant by National Association of Kogi State Students, Youth Libra for Award by the Visioners Club of Kogi State, the Great Motivator of Students by Nigerian Economic Student Association, Icon of Good Leadership by Kogi Peoples Forum, 2008 Diplomatic Member of the year by St Monica’s College Kabba and the most performed National Legislator by Vision 2020 Youth Group. Most vibrant Honourable member, Abuja merit Awards African Parliamentarian of the year 2005 in U.S.A. Na Melaye win di Senato Awod of di year in 2017 an 2018.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Senator Melaye graduated from Abu Zaria- VC confirms. News Agency of Nigeria .From the original. 21 May 2018. Retrieved September 14 2023.

2. Bukola Saraki emerges Senate President. Vanguard Newspaper. Retrieved 10 November 2023.